Blog
Your blog category
-
Isaiah Chapter 8
Assyrian Go Take-over Di Land Warning To Fear Baba-God 11. Naso Baba-God take follow me tok wit strong hand, con tell me sey make I no follow di way of dis pipo—sey, 12. “No join di rebel plan of di pipo, no fear di tins wey dem dey fear. 13. Na Baba-God Almighty of heaven you go reason as Holy. Na only am you suppose dey fear; only am nahin suppose dey make you shake. 14. And he go be holy-place for you, but for di two house of Israel—he go be road block plus stone wey dey make dem fall. And he go be trap plus hook for di…
-
Isaiah Chapter 9
Di Govment of Di Pikin Wey Go Come Di Punishment Of Samaria 8. Baba-God send word against Jacob, and e don fall on Israel. 9. And all di pipo go know, even Ephraim, plus di pipo wey dey stay for Samaria wey dey feel-big as dem dey yarn wit stubbornness, 10. “We go change di blocks wey don break wit fine stones: di sycamore trees don cut, but we go change dem to cedars trees.” 11. So Baba-God go set di enemies of Rezin against am, con join hin enemies togeda. 12. Di Syrians go dey for front, and di Philistines for back, and dem go swallow Israel wit dia…