Blog

Your blog category

  • Exodus Chapter 34

    Di New Stones Wit Writings New Agreement 10. Baba-God con tok sey, “I dey make agreement wit you. I go do ogbonge tins for front of all your pipo—wey neva happun before for di earth or for any nation of di world. All di pipo wey dey around you go see as di kain ogbonge work wey me Baba-God, go do for you; becos na ogbonge tin I go do for you. 11. Obey di tins wey I dey tell you today. I go pursue di Amorites from your front, di Canaanites, Hittites, Perizites, Hivites, plus Jebusites. 12. Dey careful so dat you no go make agreement wit those pipo…

  • Exodus Chapter 35

    Laws For Di Sabbath Materials For Di Worship-place 4. Naso Moses tell all di pipo of Israel sey, “Dis na wetin Baba-God dey tell una to do: 5. ‘Take offering for Baba-God from wetin una get. Everi pesin wey get open heart to give Baba-God offering of gold, silver, bronze; 6. Blue, purple and red thread, plus fine linen and goat hair; 7. ram skin wey dem dye to red, badger leather, plus shittim wood; 8. ororo for di light, spices for di anointing ororo and for di incense wit scent; 9. Plus onyx stone and oda fine-stones wey dem go put for di priest-cloth plus di chest-cloth. Workers Wey…