Blog
Your blog category
-
Leviticus Chapter 16
Di Law Of Cleaning Sins Di Sin Offering For Di Priest 11. “Make Aaron bring di small-malu for hin own sin offering to sacrifice for hin sin and hin family. Den he go kill di small-malu for hin own sin offering. 12. Make he carry incense-container wey full wit hot charcoal wey dey burn from di altar for Baba-God front, plus hin two hands wey full wit fine incense wey dem grind, con carry dem go back of di curtain. 13. Make he put di incense for faya for Baba-God front, and di smoke of di incense go raise up, con cover di cover of di Ark [di mercy chair]—wey…
-
Leviticus Chapter 17
Blood Dey Holy No Chop Blood Wey Baba-God Forbid 10. “Any pesin from Israel, or foreigner wey dey live among una, wey chop any kain blood—I go dey against dat pesin wey chop blood, and I go cut am komot from hin pipo. 11. Becos di life of any animal dey for di blood, and I don give am to una—to clean una sins for di altar, and to settle una wit Baba-God. Di blood wey una give to exchange for life nahin dey make pesin clean. 12. So I dey tell di pipo of Israel sey, “Make none of una chop blood, and make no foreigner wey dey stay…