Blog

Your blog category

  • Numbers Chapter 11

    Di Pipo Con Dey Complain Di Seventy Senior-men 16. Baba-God con tell Moses sey: “Bring seventy of di senior-men of di pipo of Israel, wey you know as leaders and officers among di pipo. Make dem come di worship-place, so dat dem go stand wit you for there. 17. I go come down, con follow you tok for there, and I go komot di spirit wey dey inside you, con put am inside dem. Dem go epp you carry di wahala of di pipo so dat no be only you go carry am. 18. “Tell di pipo sey: ‘Make una clean unasef, becos una go get meat to chop tomorrow.…