Blog

Your blog category

  • Numbers Chapter 15

    Laws About Sacrifices Offering For Sin Wey Pesin Commit Wit-out Knowing 22. “But if una no know, con forget to do all dis tins wey Baba-God command tru Moses— 23. And if una and una pikin-pikin-pikin for future no gree do everitin wey Baba-God tell Moses to tell una—from di day wen Baba-God give di law— 24. And if una make dis mistake wit-out knowing, and di community no know about am, den di whole community go offer small-malu for burnt offering, as sweet scent wey Baba-God like. Dem must offer am wit di seeds, plus di drink offering, based-on wetin Baba-God tell Moses, plus one he-goat for sin offering.…

  • Numbers Chapter 16

    Korah, Datham Plus Abiram Di Pipo Complain 42. Di next day, all di pipo of Israel con dey tok against Moses plus Aaron. Dem tok sey, “Una don kill Baba-God pipo.” 43. But e con happun sey, wen di pipo gada against Moses plus Aaron, con turn dey face di worship-place, before you know, naso cloud just cover am, and Baba-God levels just show-face. 44. So Moses plus Aaron con go front of di worship-place, 45. and Baba-God con tell Moses sey, 46. “Shift komot from dis pipo wey gada so dat I go fit end dem now-now-now.” Naso dem fall face down 47. So Moses tell Aaron sey, “Take…