Blog

Your blog category

  • Deuteronomy Chapter 1

    Di Command To Komot From Horeb Dem Choose Leaders For Di Tribes 9. Around dat time, I tell una sey, “Una be like load wey too heavy for only me to carry. 10. Baba-God wey be una Oga don make una plenty— sote today una don plenty like stars for sky. 11. Make Baba-God, di God of una papa-papa-papa make una plenty one thousand times more, con bless una as he promise una! 12. But how only me go take carry una wahala plus  palava, and una kwanta? 13. Choose some men wey wise wey sabi, and wey get understanding, and wey get levels—from everi single one of una tribes,…

  • Deuteronomy Chapter 2

    Waka-waka Inside Desert        As Dem Take Win Sihon Wey Be Di King of Heshbon 24. “Stand up, make una dey move now, con cross River Arnon. See, I don put Sihon wey be di king of  di Amorite for una hand, king of Heshbon, wit hin land. Make una start to dey claim di land, and start  war wit am. 25. From today I go start to dey make di nations wey dey under heaven—fear una, and dia mind go cut wen dem hear about una. Dem go hear gist about una and dem go start to dey shake, and dem go dey  worry becos of una.” Dem Win…