Blog

Your blog category

  • Deuteronomy Chapter 5

    Di Agreement For Horeb Di Pipo Fear As Baba-God Show-face 23. E con happun sey, wen una hear di voice from inside di darkness, as di mountain dey burn wit faya, una come meet me, even all di leaders of una  tribes and una senior-men come meet me; 24. And una tok sey, “Baba-God awa Oga don show us hin levels and hin big pawa. We don hear hin voice  from inside di faya. We don see sey pesin no die even if Baba-God follow am tok. 25. But why we go con die now? Dis heavy faya go burn us, and we go die if we kontinu to hear Baba-God…

  • Deuteronomy Chapter 6

    Love Baba-God Una Oga Warning So Dat Dem No Go Disobey 10. Wen Baba-God wey be una Oga carry una enta di land wey he swear to give una ancestors; Abraham, Isaac plus Jacob, to give una land wit big beta cities  wey una no build, 11. Houses wey yanfu-yanfu wit everi beta-beta-tins wey una no gada, wells wey una no dig, and grape-farms and olive trees wey una no plant—den wen una chop con belleful, 12. Make una watch so dat una no go fashi Baba-God wey carry una komot from inside Egypt—komot from di land wey una be slaves. 13. Fear Baba-God wey be una Oga, serve only…