Blog

Your blog category

  • Deuteronomy Chapter 9

    Baba-God Go Scata Di Pipo of Canaan Di Golden Malu                                 7. Remember dis tin and make una no forget how una  take make Baba-God vex for inside desert. From di  day wen una komot from Egypt, until una reach here, una dey disobey Baba-God. 8. Evensef, una make Baba-God vex for Horeb—sote  he con vex reach to scata una. 9. Wen I go up to di mountain to collect di stones wit writings, di stones wit di writings of di agreement wey Baba-God make wit una, I stay for di mountain for forty days plus forty nights; I no chop any food or drink water. 10. Baba-God give me two stones…

  • Deuteronomy Chapter 10

    Di New Stones wit Writings Di Fear of Baba-God 12. And now, wetin Baba-God una Oga dey ask for, but make una fear Baba-God una Oga, to follow all hin ways, and to love am, and to serve Baba-God una Oga wit all una heart and soul, 13. to keep di commandments of Baba-God, and di laws  wey I dey give una today so dat e go beta for una? 14. See, Baba-God una Oga nahin get di heavens, even di highest heavens, even di earth plus everitin wey dey for inside am. 15. But Baba-God happy for una ancestors, con love dem, and he choose una wey be dia…