Blog
Your blog category
-
Deuteronomy Chapter 11
Blessings Wen Una Obey Blessing Plus Curse 26. See, I dey put both curse and blessings for una front. 27. Una go get blessings, if una obey di laws of Baba-God wey be una Oga—di laws wey I dey tell una today. 28. But na curse, if una no gree obey di laws of Baba-God una Oga, con turn from di words wey I don tell una today, by following oda gods wey una know sabi before. 29. Wen Baba-God una Oga don carry una enta di land wey una dey enta to claim, una go tok Baba-God blessings for mountain of Gerizim, con tok di curses for Mountain Ebal.…
-
Deuteronomy Chapter 12
One Place For Worship Warning Against Fake Gods 29. Wen Baba-God don cut di nations komot from una front—di nations wey una wan take-over, con pursue; wen una don pursue dem komot, con settle down for dia land, 30. make una dey careful so dat una eyes no go shuuk to fall enta trap—or follow dia traditions and worshipping dia gods, afta dem bin scata komot from una front. Make una no ask about dia gods, con tok sey, “How dis nations take dey serve dia gods? We go do di same tin.” 31. Una must no worship Baba-God in dia way, becos dem dey worship dia gods wit everi…