Blog
Your blog category
-
Deuteronomy Chapter 17
Oda Laws Di King 14. Wen una enta di land wey Baba-God una Oga dey give una, and una don claim am, con settle down for di land, and una con tok sey, “Make we choose king wey go lead us like all di nations wey dey around us,” 15. Make una dey sure sey una select king wey Baba-God choose. He must be pesin among una brodas. Make una no choose foreigner as una leader—wey no be your broda. 16. But di king must no collect too many horses for hinsef, or make di pipo go back to Egypt to get more horses, becos Baba-God don tell you…
-
Deuteronomy Chapter 18
Offering For Di Priests Plus Di Levites Tins Wey Be Tufiakwa 9. Wen una enta di land wey Baba-God una Oga dey give una, make una no learn how to copy di tufiakwa ways of di nations wey dey for there. 10. Make no pesin dey among una wey dey sacrifice hin pikin for faya, or wey dey read pipo future, or do jazz, or witch [kpians], 11. or pesin wey dey do otumorkpor, or pesin wey dey tok to dead pipo, or pipo wey dey tok to spirits. 12. All di pipo wey dey do dis kain tins na tufiakwa for Baba-God; becos of all dis kain tufiakwa…