Blog

Your blog category

  • Deuteronomy Chapter 31

    Joshua Na Di New Leader of Israel Dem Go Read Di Law Everi Seven Years 9. So Moses write dis law, con give am to di priests, di sons of Levi, wey dey in charge of Baba-God Ark, and to all di senior-men of Israel. 10. Naso Moses tell dem sey, “For di end of everi seven years, di Year of Release, around di time of di Festival of Tents, 11. wen all di pipo of Israel gada to worship Baba-God for di place wey he go choose, make una go read dis law for front of all di pipo of Israel, make dem hear am. 12. Gada di pipo togeda, men…

  • Deuteronomy Chapter 32

           Moses Song     Baba-God Tell Moses As He Go Take Kpeme 48. Dat same day, Baba-God tell Moses sey, 49. “Go Moab, to di mountains, climb mountain Nebo wey dey opposite Jericho. Look di land of Canaan wey I wan give di pipo of Israel as dia property. 50. Na for on top of di mountain nahin you go kpeme. You go join your ancestors just like Aaron wey join hin ancestors, con kpeme for mountain Hor. 51. Di two of una betray me wit di pipo of Israel for di waters of Maribah for Kadesh for di desert of Zin. You no gree show di pipo of Israel my…