Ecclesiastes Chapter 1
All Na Vanity
- Dis na di words of one preacher, wey be David pikin, king of Jerusalem.
- Di preacher tok sey, “Vanity upon vanities, all na vanities (notin make-sense at-all)”
- Wetin man dey gain from all di hustle wey he dey hustle under di sun?
- One generation go pass komot, and anoda one go show-face, but di earth go dey forever.
- Di sun sef dey rise, e go go down, con dey rush go back to where he rise from.
- Di breeze go blow go south, con turn go back to north; e dey roll round everi time, and e dey come back as e dey move round.
- All di rivers dey flow enta di big-river; but di big-river no dey gree full, dem go flow go back to where di river dey come from again.
- Everitin get wahala pass wetin mouth fit tok am; eyes no dey belleful wit wetin e see, and ears no dey taya to hear.
- Wetin don happun before go still happun again, dem go repeat wetin dem don do before, and notin dey new under di sun.
- Abi e get anytin wey pipo go tok sey, “See, dis tin na new tin”? E bin dey before-before, since olden days, before we show.
- Pipo no dey remember wetin happun before-before, and for di generations wey go come—no pesin go remember wetin dey happun now.
Solomon Own Experience
12. Me di preacher be king of Jerusalem.
13. And I calm down to put-mind to fyne wisdom about everitin wey pipo dey do under heaven: serious load and wahala nahin Baba-God don give men pikin wey go give dem wahala—to make dem busy.
14. I don see evertin wey pipo dey do under di sun; dem no get meaning (vanity)—e be like wen pesin dey pursue breeze.
15. Wetin don bend no fit straight, and you no fit count wetin dey miss.
16. I reason for inside my heart, con tok sey, “See, I don be great man, con wise more-more pass di pipo wey dey before me, for inside Jerusalem. My heart don see plenty wisdom plus knowledge.
17. And I put my heart to sabi wisdom, madness and mumu: I con see sey dis tins sef be like sey pesin dey pursue breeze.
18. If pesin too wise, sadness go plenty, and pesin wey know plenty-plenty tin—go get plenty pain.