Ecclesiastes Chapter 3
Time Dey For Everitin
- Everitin get e season, and time dey for everitin wey dey happun—for under heaven [life na turn by turn]:
- Time dey wey dem go born pesin, and time dey for di pesin to kpeme; time for planting dey, and time dey to pluck wetin dem plant.
- Time for killing dey, and time to heal dey: Time to break down, and time to build;
- Time dey for cry-cry and time dey for laff-laff; time dey to mourn, and time dey for dance-dance.
- Time dey to scata stones, and time dey wen dem go gada stones togeda; time dey to hold tins join body, and time dey to komot hand from tins.
- Time dey for pesin to get tins, and time dey for pesin to lose tins; time to keep tins dey, and time to throway dem dey.
- Time dey to tear, and time dey to sew; time dey for pesin to dey silent, and time dey to yarn.
- Time for love dey, and time to hate dey; time for war dey, and time for peace dey.
- Wetin pipo dey gain from all dia hustle [hard work]?
- I don see di hard work of pain wey Baba-God don give di sons of men to dey do.
- He make everitin fine for hin time: evensef, he don put di everlasting world for inside men heart, so dat no man go fit sabi di works wey Baba-God don make from di starting to di end.
- I know sey notin beta for dem pass make dem dey happy, and to do good all dia lives.
- And make everi man chop and drink, con enjoy everitin wey he don work for—dis na gift from Baba-God.
- I know sey everitin wey Baba-God dey do dey last forever; notin fit add-join and notin fit komot from am. Baba-God don do am like dis, so dat pipo go fear am.
- Wetin dey happun now, and wetin go happun—don already happun before. But, Baba-God no dey forget, he dey fyne wetin don happun before. (He dey make tins happun again.)
Injustice of Life
16. But I notice sometin wey dey happun under di sun; I see sey wickedness dey for where justice suppose dey, and I see sey evil dey for di place where goodness suppose dey. (Evil for inside court).
17. I con tok for inside my heart sey, ‘Baba-God go judge both good and bad pipo; becos time dey for everitin wey dey happun and for everi work.
18. I still reason for inside my heart about di condition of human being. Baba-God dey test dem so dat dem go fit see sey demsef be like animals.
19. Las-las, na wetin go happun to human being—nahin go happun to animal sef; as one take dey die, naso di oda one sef dey die. True-true, dem get di same breath; man no get anytin wey beta pass animal—all of dem no make-sense (na vanity).
20. All of dem dey go di same place; all of dem come from dust, and dem go go back to dust.
21. Who fit confam sey human being spirit dey go up-up, and sey animal spirit dey go down-down inside di earth?
22. So I see sey notin beta pass sey make pesin enjoy wetin he hustle for; becos na dat one be hin share: becos who fit carry am come back to see wetin go happun afta he don komot?