Ezekiel
-
Ezekiel Chapter 48
Di Sharing Of Di Land “Na dis be di names of di tribes: From di north border along di road to Hethlon to Hamath—to Hazar-enan, to di north border of Damascus—go reach Hamath. Di area stretch go di sides of di land of Israel from east to west—nahin be one portion for Dan. “Asher go get one portion; e go share border wit di territory of Dan—from di east to di west side. Naphtali go get one portion; e go share border wit di territory of Asher from east to west. Manasseh go get one portion; e go share border wit di territory of Naphtali from east to west. Ephraim…
-
Ezekiel Chapter 47
Di Water From Under Baba-God House For inside my vision, di man carry me come back to di doormot of Baba-God house. Na for there, I con see water wey dey flow from bottom of di doormot of di house, for di east side: becos di front of di house dey for di east side, and di water dey come from under di right side of di house, for di south side of di altar. Naso di man carry me go outside di wall tru di north gate, con carry me around for di outside—to di outside gate wey dey face di east; na for there I see di water…
-
Ezekiel Chapter 46
Di Prince Offerings ‘Dis na wetin Baba-God tok: “Di gate of di inner yard wey dey face di east must dey closed for di six days of work, but on di Sabbath day and on di day of di New Moon—make dem open di door. Di prince go enta from di room wey dem take dey enta wey dey for outside. Den he go stand near di doormot of di gate. Naso di priest go arrange hin burnt offering plus peace offerings. He go bow down to worship for di doormot of di gate, con go back outside from di way he pass enta. Make dem no close di gate…