Ezekiel Chapter 15

Abeg share

Jerusalem Na Useless Vine Tree

  1. Baba-God word come meet me:
  2. “Man pikin, how di wood of vine tree take beta pass any oda tree, or di branch of any oda tree wey dey among di trees inside forest?
  3. Abi dem dey take wood from am take do anytin wey make-sense? Abi dem dey use am take make peg to hang containers?
  4. E only good to make faya like fuel. And wen di ends don burn and di middle don burn to ashes, abi men fit use am take make any beta tin?
  5. E dey useless even before e burn. Now wey di faya don burn am, con turn am to ashes, e even dey more useless.”
  6. So dis na wetin Baba-God Almighty dey tok, “As I don give di wood of vine trees among di trees wey dey for forest—as fuel for faya, naso I go do di pipo wey dey live for inside Jerusalem.
  7. I go set my face against dem. Even though dem don come out from one faya, anoda faya go still burn dem. Naso dem go sabi sey na me be Baba-God wen I change-am-for  dem.
  8. I go make di land empty, becos dem don turn komot from my way,” naso Baba-God Almighty tok.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *