Ezekiel Chapter 2
Baba-God Call Ezekiel
- He con tell me sey, “Man pikin, stand up and I go follow you tok.”
- As he dey tok to me, di Spirit enta inside me, con carry me stand up, so I hear am dey follow me yarn.
- Naso he tok sey, “Man pikin, I dey send you go meet di pipo of Israel, to nation wey no wan gree follow me and nation wey don change-am-for me. Dem plus dia papa no gree follow me till today.
- Di pipo wey I dey send you go meet na pipo wey get coconut-head and wey no dey gree. Tell dem sey, ‘Dis na wetin Baba-God Almighty tok.’
- And whether dem listen or dem no gree listen—dem be house di of pipo wey no dey follow me—dem go know sey prophet don dey wit dem.
- And you, man-pikin, no dey fear dem or fear wetin dem dey yarn. No dey fear even though dem surround you like shuuku-shuuku plus wild flower wey sharp, and you dey live among scorpions; no fear dia words and no let your mind-cut becos of di way dia face be, even though dem be house of pipo wey dey turn against me.
- You must follow dem tok my word, whether dem listen or dem no gree listen, becos dem be pipo wey no wan gree follow me at-all.
- But you, oh man pikin, listen to wetin I dey tell you. No disobey like di house of dis pipo wey no wan gree follow me; open your mouth and make you chop wetin I give you.”
- Naso I look, I con see one hand wey stretch to me. Di hand carry one book.
- He open di book for my front. Dem write songs of sadness, cry-cry, plus wahala—for di front and back of di book.