Ezekiel Chapter 25

Abeg share

Prophecy Against Ammon

  1. Message from Baba-God come meet me again, sey:
  2. “Man pikin, set your face against di land of Ammon, con prophesy against dem.
  3. Tell dem sey, ‘Hear Baba-God Almighty word. Dis na wetin Baba-God Almighty tok: Becos una tok sey, ‘Ntoor,’against my holy-place wen dem corrupt my House, and una yab Israel for her scata-scata, con laff Judah as dem dey carry dem as prisoners of war;
  4. So I go carry una give di pipo of di east—as dia property. Dem go build dia palaces for una place, con settle down among una; dem go chop una fruits, con drink una milk.
  5. I go turn Rabbah to place where camels go dey chill, and I go turn Ammon to place where sheep  go dey rest. Den una go sabi sey na me be Baba-God.”
  6. ‘Becos dis na wetin Baba-God Almighty tok: “Becos una clap una hands and jump up, con dey happy for inside una heart wit una badbelle for di land of Israel,
  7. naso I go stretch out my hand against una and I go allow di nations rob una. I go cut una komot from di nations, con komot una from di kontris. I go scata una, and una go sabi sey na me be Baba-God.’ ”

Prophecy Against Moab

8. ‘Dis na wetin Baba-God Almighty tok: “Becos Moab plus Seir tok sey, ‘See, di house of Judah don be like oda nations,’

9. I go allow pipo attack di cities wey defend di border of Moab, plus even di finest cities— Bethjeshimoth, Baalmeon, and Kiriathaim.

10. I go let di tribes wey dey for di eastside of di desert beat Moab, togeda wit Ammon. I go give dem to dia enemies—sote di pipo of Ammon no go fit be nation again.

11. And I go suffer Moab wit punishment. Naso dem go sabi sey na me be Baba-God.”

Prophecy Against Edom

12. ‘Dis na wetin Baba-God Almighty tok: “Becos Edom revenge against di house of Judah, con commit big sin by doing like dat,”

13. naso Baba-God Almighty tok: “I go stretch out my hand to attack Edom, con kill di pipo plus dia animals. I go turn am to waste, and from Teman reach Dedan—dem go fall by di sword.

14. I go revenge on Edom wit di hand of my pipo Israel, and dem go deal wit Edom based- on my vex and para, and dem go see my vex,” naso Baba-God Almighty tok.

Prophecy Against Philistia

15. ‘Dis na wetin Baba-God Almighty tok: “Becos di Philistines revenge on dia old enemies, con use badbelle take scata dem wit revenge for dia heart;

16. So, dis na wetin Baba-God Almighty tok: “I go stretch my hand against Philistine, and I go cut di Kerethites komot, con dabaru those wey remain along di water-side.

17. I go revenge well-well on dem, con punish dem as I dey vex. Naso dem go sabi sey na me be Baba-God, wen I revenge on dem.”’”

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *