Ezekiel Chapter 35
Judgement On Mountain Seir
- Message from Baba-God come meet me, sey:
- “Man pikin, set your face against di mountain of Seir; prophesy against am,
- con tok sey: ‘Dis na wetin Baba-God tok: “See, I dey against you, oh Mountain Seir, and I go stretch out my hand against you, con make you turn to empty waste land kpatakpata.
- I go turn your cities to scata-scata, con make you empty. Den you go sabi sey na me be Baba-God.
- Becos una always get badbelle for di pipo of Israel since olden days, con kill dem wit di pawa of sword wen dem dey face wahala, for di time wen I don already punish dem for dia sins,
- So, as surely as I dey live,” naso Baba-God tok, “I go give una to pipo wey go shed una blood, and blood go pursue una. Since una no hate killing, so na blood go pursue una.
- I go turn di mountain of Seir to empty waste land kpatakpata, con cut komot all di pipo wey dey go or come from there.
- I go full hin mountain wit di deadbody of hin men; those pipo wey sword kill go fall on top of your hills, for bottom of your mountains, and inside una rivers go burku wit pipo wey dem kill wit sword.
- I go make you empty forever; pipo no go live for your cities again. Naso you go sabi sey na me be Baba-God.
- “Becos you tok sey, ‘Dis two nations and dis two kontris go be awa own, and we go claim dem,’ even though me—Baba-God dey for there,
- So as surely as I dey live,” naso Baba-God Almighty tok, “I go do una based-on di vex and jealousy wey una show inside una badbelle against dem, and I go show mysef among dem wen I judge una.
- Naso una go sabi sey me Baba-God, and I don hear all di insults wey una tok against di mountains of Israel; una tok sey, ‘Dem don scata kpatakpata, and dem don fall for awa hand—for us to chop.’
- And I don hear as una dey make-mouth against me, and una don tok plenty tok against me.”
- Dis na wetin Baba-God Almighty tok: “Wen di whole earth go dey celebrate, I go turn una to waste land.
- As you bin dey happy wen di land of di pipo of Israel empty, naso I go do una. Una go empty kpatakpata, oh Mountain Seir, you plus di whole Idumea (Edom)—even all of am! Naso dem go sabi sey na me be Baba-God.”’