Ezekiel Chapter 48

Abeg share

Di Sharing Of Di Land

  1. “Na dis be di names of di tribes: From di north border along di road to Hethlon to Hamath—to Hazar-enan, to di north border of Damascus—go reach Hamath. Di area stretch go di sides of di land of Israel from east to west—nahin be one portion for Dan.
  2. “Asher go get one portion; e go share border wit di territory of Dan—from di east to di west side.
  3. Naphtali go get one portion; e go share border wit di territory of Asher from east to west.
  4. Manasseh go get one portion; e go share border wit di territory of Naphtali from east to west.
  5. Ephraim go get one portion; e go share border wit di territory of Manasseh from east to west.
  6. Reuben go get one portion; e go share border wit di territory of Ephraim from east to west.
  7. Judah go get one portion; e go share border wit di territory of Reuben from east to west. 8. For di border of Judah, from di east side to di west side, nahin go be di area wey una go separate. E go long reach 12 ½ kilometers, and e go wide from di east border of Israel, for di west side of di Mediterranean Sea. E go long reach one of di oda part of di land for di tribes. Na di middle of dis area Baba-God house go dey.
  8. For di center of dis area, una go keep special place wey long reach 12 ½ kilometers, con wide reach 10 kilometers.
  9. Na dis go be di holy area for di priests: For di north side, e go long reach 12 ½ kilometers, for di west side, e go wide reach 5 kilometers, for di east side e go wide eash 5 kilometers, and e go long reach 12 ½ kilometers for di south side. Baba-God house go dey for di middle of dis area.
  10. Dis holy area go be for di holy priests wey be di pikin-pikin-pikin of Zadok. Dem serve me and dem do dia work; dem no gree join di remaining pipo of Israel do wrong tins just like di oda Levites.
  11. E go be special gift to dem from di holy part of di land, di most holy part— e go share border wit di area of di oda Levites.
  12. Di Levites sef go get special area, for di south side of di priests. Di place sef go be 10 miles from east to west, 4 miles from north to south.
  13. Dem must no sell or exchange anytin of am. Na dis be di best part of di land, and e must no enta oda pipo hand, becos e dey holy for Baba-God.
  14. Di part of di special area wey remain—wey wide reach 8,750 feet, con long reach 43,750 feet, no dey holy, but everi pesin fit use dat area. Dem fit live for there and use di land. Make di city dey for di middle of di place,
  15. Na dis go be dis measurement of di city: 1 ½ miles for di north side, 1 ½ miles for di south side, 1 ½ miles for di east side, and 1 ½ miles for di for di west side.
  16. All round di city, for everi side, make open space dey wey be 437 ½ feet for di north side, 437 ½ feet for di south side, 437 ½ feet for di for di east side, plus 437 ½ feet for di west side.
  17. Outside di city, farmland go dey wey long reach 17,500 feet for di east side, and 17,500 for di west side, along di border of di holy area. Na dis land go produce food for di pipo wey dey work for di city.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *