Genesis Chapter 15
Abram Agreement
- Afta dis tins, Baba-God word meet Abram for vision, sey, “No dey fear, Abram: na me be your guard, plus your big-big gain.”
- Abram con tok sey, “Baba-God, wetin you go give me, as you see sey I no get pikin so, and na Eliezer of Damascus go con claim my properties?”
- Naso Abram tok sey, “See, you neva give me any pikin, so na servant wey dey for my house go claim my properties.”
- So Baba-God word come meet am sey, “Dis man no go be di pesin wey go claim your properties, but e go be your sons, wey be your own flesh and blood, nahin go claim your properties.”
- He carry am go outside, con tok sey, “Look up for sky, make you count di stars—if you no fit true-true count dem, naso your pikin sef go be.”
- So he believe Baba-God, and Baba-God count am for am as pure-heart.
- Baba-God con tell am sey, “Na me be di God wey carry you komot from Ur of di Chaldeans, to give you dis land as your property.”
- So Abram tok sey, “Almighty God, how I go take know sey e go belong to me?”
- Naso Baba-God tell am sey, “Carry malu come, plus goat, and ram—and make dem be three years old, wit dove plus small pigeon.”
- Abram carry di animals come meet Baba-God, he cut dem in two two, con put di two half side opposite demsef, but he no cut di birds.
- Naso di birds of di sky come down for di deadbody, Abram pursue dem komot.
- So wen di sun start to dey go down, Abram con start to dey sleep deep, naso fear plus serious darkness cover am.
- Baba-God con yarn am sey, “Your pikin-pikin-pikin go be stranger [jjc] for foreign land; dem go be slaves for there, and dem go do dem any how for four hundred years.
- And I go judge di nation wey dem go serve sef, and lata, dem go come out wit plenty beta-beta-tins.
- And you go go meet your ancestors in peace; dem go bury you wen you don old well-well.
- But di fourth generation nahin go come back here to dis land, becos I no go pursue di Amorites until dia sins dey enuff for me to scata dem.
- E con happun sey wen di sun go down, and darkness con dey, one faya pot wit smoke and stick of faya just show-face, con pass between di pieces of di animals.
- On di same day, Baba-God make agreement wit Abram sey, “I don give your pikin dis land, from di river of Egypt reach di great river, di river of Euphrates:
- Di Kenites, plus di Kenizzites and di Kadmonites, And di Hittites, plus di Perizzites, and di Rephaims,
- And di Amonites, plus di Cannanites, and di Girgashites, and di Jebusites.