Genesis Chapter 16
Hagar plus Ishmael
- Now Sarai wey be Abram wife no fit born pikin for am, and she get one house-girl, Egyptian girl wey her name na Hagar.
- So Sarai tell her husband sey, “See now, Baba-God no gree let me carry belle, abeg go meet my house-girl; e fit be sey I go get pikin from her. So Abram listen to di voice of Sarai.
- So Sarai, Abram wife carry Hagar—her house girl wey be Egpytian give her husband Abram so dat e go marry her—dis na afta Abram don stay for di land for ten years.
- Abram sleep wit her, so she carry belle, and wen she see sey she don get-belle, she con dey feel-big, and she do Sarai anyhow.
- So Sarai con tell Abram sey, “Na your fault sey Hagar dey do me anyhow: I don give you my house-girl, and wen she see sey she don get-belle, she con dey hate me: make Baba-God judge between you and me.
- But Abram tell Sarai sey, “See, na you dey control your house-girl, do her anytin wey you want. So wen Sarai treat her wit strong hand, naso she run komot.
- So Baba-God angel see her near one water wey dey flow for desert for di road to Shur.
- Di angel con yarn her sey, “Hagar—Sarai house-girl, where you dey come from? And where you dey go?” So she tok sey, “I dey run from my madam—Sarai.”
- Naso Baba-God angel tell her sey, “Go back to your madam, make you dey under her control.”
- Baba-God angel con tok sey, “I go make your pikin plenty well-well, sote dem no go fit count dem.
- You dey wit pikin and you go born baby-boy. And you go call hin name Ishmael, becos Baba-God don hear your suffer-head.
- He go be wild man, hin hand go dey against everi man, and everi man hand go dey against am; and he go live wit badbelle for all hin brodas.
- Hagar tok sey, “I don see Baba-God and I still dey alive for here.” So she call Baba-God name, wey follow her tok, ‘Baba-God, wey dey see me.’
- Nahin make pipo dey call di well between Kadesh and Bered, “Beer-Lahai-Roi” [wey mean, “Di Well of di Living One Wey Dey See Me.”]
- So Hagar born baby-boy for Abram, and Abram call di son name wey Hagar born for am—Ishmael.
- Abraham na eighty-six years old dat time wen Hagar born Ishmael for am.