Genesis Chapter 5

Abeg share

Di Family of Adam

  1. Dis na di book of di generations of Adam. For di day  wey Baba-God make man, Baba-God make man to resemble am.
  2. He make dem—man and woman. He bless dem, con  call dem Man—on di day wen he make dem.
  3. And Adam live for hundred and thirty years, con born baby-boy wey resemble am, and wey get hin image— hin name na Seth:
  4. So Adam live for eight hundred years afta he born Seth, and he born boys and girls.
  5. Adam live for nine hundred and thirty years before he kpeme.
  6. Seth live for hundred and five years before he born Enos:
  7. Afta Seth born Enos, he live for eight hundred and seven years and he born boys and girls.
  8. So Seth live for nine hundred and twelve years before he kpeme.
  9. Enos live for ninety years before he born Cainan:
  10. Afta Enos born Cainan, he live for eight hundred and  fifteen years, and he born boys plus girls.
  11. And Enos live for nine hundred and five years before he kpeme.
  12. Cainan live for seventy years before he born Mahalaleel:
  13. Cainan live for eight hundred and forty years afta he born Mahalaleel, and he born boys and girls.
  14. Cainan live for nine hundred and ten years before he  kpeme.
  15. Mahalaleel live for sixty five years, con born Jared:
  16. Mahalaleel live for eight hundred and thirty years  afta he born Jared, and he born boys plus girls.
  17. Mahalaleel live for eight hundred and ninety five years before he kpeme.
  18. Jared live for hundred and sixty two years, con born Enoch:
  19. Jared live for eight hundred years afta he born Enoch, and he born boys plus girls.
  20. And Jared live for nine hundred and sixty two years before he kpeme,
  21. Enoch na sixty five years wen he born Methuselah:
  22. So Enoch waka wit Baba-God for three hundred years  afta he born Methuselah, and he born boys plus girls.
  23. And Enoch live for three hundred and sixty five years.
  24. And Enoch waka wit Baba-God, and he move—Baba-God carry am komot.
  25. Methuselah live for hundred and eighty seven years, he con born Lamech.
  26. Methuselah live for seven hundred and eighty two  years, and he born boys plus girls.
  27. Methuselah live for nine hundred and sixty nine  years before he kpeme.
  28. Lamech live for hundred and eighty two years, con  born baby-boy.
  29. He call am Noah, con tok sey, “Dis one go make us cool down from awa work and hustle of awa hand, becos of di ground wey Baba-God don curse.”
  30. Lamech live for five hundred and and ninety five years afta he born Noah, and he born boys plus girls.
  31. Lamech live for seven hundred and seventy seven  years before he kpeme.
  32. Afta Noah be five hundred years, he born Shem, Ham,  plus Japhet.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *