Las-las Yarnings
- Make una kontinu to dey love unasef as brodas and sistas.
- No forget to accept jjc, naso pipo take epp angels and dem no know.
- No fashi those pipo wey dey for prison—as if you dey for prison wit dem, and remember those pipo wey dey face wahala—as if yousef dey suffer wit dem.
- Everi-pesin suppose respect marriage and dey faithful for marriage: but Baba-God go judge pipo wey dey sex-anyhow, plus pipo wey dey climb pesin husband or wife.
- Free your life from longatrot [ogboju for moni], and belleful wit wetin you get, becos Baba-God tok sey, “I no go ever bone you; or fashi you.”
- So we fit use full-mind tok sey, “Baba-God na my epper; fear no go catch me. Wetin man fit do me sef?
- Remember una leaders, wey follow una tok Baba-God word. Reason di result of dia way—and copy dia faith.
- Jesus Christ na di same yesterday, today and forever.
- No waka-lose wit different, and strange ideas. E dey good make awa heart stand gidigbam by grace, no be by rules about food, wey di pipo wey dey follow dem—no dey gain anytin from.
- We get altar wey di pipo wey dey serve inside di worship-place—no get right to chop from.
- Di high priest go carry di blood of di animal enta di Holy- place as offering of sins, but dem go con burn di body outside di camp.
- Naso Jesus sef take suffer outside di city gate, to make pipo holy tru hin blood.
- Make we sef go meet am outside di camp, as we suffer di disgrace wey he suffer.
- We no get any city wey go last forever for dis world, but we dey wait for di city wey go come.
- Tru Jesus, make we always dey give Baba-God sacrifice of praise—wey be di fruit of awa lips wey dey give tanks to hin name.
- And no forget to do good, and share wit pipo wey need epp, na dat kain sacrifice dey make Baba-God happy.
- Obey your leaders and do wetin dem sey make you do. Dem dey watch your life as men wey must give ansa to Baba-God. Obey dem so dat dia work go sweet dem, and no make dia work hard for dem—wetin you gain from dat one?
- Pray for us. We get full-mind sey we get clean-heart, and we wan live to do di right tins—for everi way.
- I dey beg una well-well to pray, so dat I no go tey come meet una.
- Make Baba-God of peace, wey raise awa Oga Jesus from di dead—di great shepherd of di sheep, tru di blood of di everlasting agreement,
- make you dey perfect for everi beta work, so dat you go fit do wetin he want, and make Baba-God work inside you, di tins wey dey good for hin eyes, tru Jesus Christ—wey dey receive all di glory for ever and ever. Amen.
- My pipo, I dey beg una to accept di message wey dey inside dis short letter wey I dey write to una.
- I wan make una know sey dem don release awa broda Timothy. If he quick come, he go follow me come see una.
- Greet all una leaders and all God-pipo. Those pipo from Italy dey send dia greetings.
- Make Baba-God grace dey wit all of una. Amen.
Post Views: 28