Isaiah Chapter 62
As Zion Go Take Save Plus New Name
- Becos of Zion, I no go dey quiet, and becos of Jerusalem—I no go rest until clean-heart start to dey shine, and salvation go be like lamp wey dey burn.
- Di nations go see your clean-heart, and all kings go see your levels, and dem go call you new name wey Baba-God mouth go give you.
- You go be crown of levels for Baba-God hand.
- Dem no go tok sey you be pesin wey dem fashi again, and dem no go tok sey your land na waste again, but dem go call you—‘Hepzi-bah,’ con call your land—‘Beulah’; becos Baba-God dey happy for you, and your land go marry.
- As young man take dey marry virgin, naso your sons go marry you; and as man wey wan marry—take dey happy for di woman wey he wan marry, naso body go sweet your God becos of you.
- I don set vigilante for your walls, oh Jerusalem. Dem must neva dey silent both for day and night. All of una wey dey pray to Baba-God, make una no keep quiet.
- No let Baba-God rest, until he make Jerusalem stand gidigbam, con make am city wey di whole world go praise.
- Baba-God don swear wit hin right hand, and wit hin strong hand, “Surely I no go give your corn as food to your enemies again, and di sons of strangers no go drink una wine, and wetin una hustle for.
- But di pipo wey gada am nahin go chop am, and dem go praise Baba-God. And di pipo wey don gada am, go drink am inside my holy house.
- Pipo of Jerusalem, make una go outside di city and make una build road for una pipo wey dey come back! Build highway; komot di stones for road! Raise up di flag for di pipo to see.
- See, Baba-God don send hin message reach di end of di earth, “Tell di daughters of Zion, ‘See, Baba-God dey come save una; see hin reward dey wit am as he dey come.’ ”
- And pipo go call dem, “Di holy-pipo, pipo wey Baba-God don save.” Dem go call Jerusalem, “Di City Wey Baba-God Love,”and, “Di City Wey Baba-God No Fashi.”