Jeremiah Chapter 4
Baba-God Call Israel By Hin Promise
- Baba-God tok sey, “If una go come back to me, chai Israel, come back to me; and if una go komot una idols wey be tufiakwa from my face, den una go dey kamkpe.
- And make una swear sey, “As surely as Baba-God dey alive,” inside truth, inside justice, and inside clean-heart. Di nations go bless demsef inside Baba-God, and Baba-God go be dia levels.”
- Becos na wetin Baba-God tell di men of Judah be dis, “Make una dig di ground wey una neva plant put! No waste una beta seeds among shuuku-shuuku.
Gbege From Di North
4. Make una circumcise unsef to Baba-God, con komot di skin wey cover una heart, oh men of Judah, and di pipo wey dey stay for Jerusalem: unless my vex go come like faya to burn una, and no pesin go fit off am; becos of di evil tins wey una dey do.
5. Tok am for Judah, and yarn for Jerusalem to everi pesin; con tok sey, “Blow di trumpet for di land; shout, ‘Make una gada togeda, and make we go di cities wey get wall.’
6. Raise flag as sign, as warning for Jerusalem: Run now! Make una no waste time!’ Becos I dey carry gbege come from di north, plus serious scata-scata.”
7. Di lion wey dey come out from e coded place; pesin wey dey scata nations dey come for road. He don komot from hin place, to scata una land. Na only scata-scata go remain from di city of Judah and no pesin go fit live for there.
8. So make una wear sackcloth, make una cry and mourn becos di serious vex of Baba-God neva turn komot from us.
9. “And e go happun for dat day,”—naso Baba-God tok—“Di king heart go kpeme, plus di heart of di princes; and di priest go surprise, and di prophets go wonder.”
10. Den I con tok sey, “Ah, Baba-God di Oga! Surely, you don deceive dis pipo plus Jerusalem, sey, ‘Una go see peace,’ wereas na sword dey shuuk inside dia soul.”
11. Dat time dem go tell dis pipo and Jerusalem sey, “Hot breeze from di desert dey go meet my pipo, no be soft breeze wey dem take dey blow or to komot dirty from seeds;
12. heavy-breeze wey too strong for those tins—nahin go come from me; now I go still tok my judgement against dem!”
13. “See, he go come up like clouds, and hin horse-moto go be like rolling-breeze: hin horses fast pass eagle. Wahala for us, awa own don finish kpatakpata!
14. Chai Jerusalem, wash your heart komot from wickedness, so dat Baba-God go fit save you. How long your evil tinking go dey inside you?
15. Dem don tok about your scata-scata for Dan, and for di mountain of Ephraim.
16. “Warn di nations wey dey around and tell Jerusalem sey, ‘Enemies dey come from far-far land, and dem dey shout di sound of war to attack di cities of Judah.
17. Dem surround Jerusalem like vigilante wey round field, becos my pipo don disobey me,’ ” naso Baba-God tok.
18. “Una ways and di tins wey una dey do, nahin make all dis tin happun to una, na una wickedness be dis, becos e bitter, becos e reach inside una heart.”
Jeremiah Cry For Judah
19. My heart, my heart—I dey feel pain! My heart dey beat wit heavy sound inside me! I no fit rest, becos I don hear di sound of di enemy trumpets, and di sound of dia war.
20. Scata-scata upon scata-scata dey roll for di land, until di land empty kpatakpata. And before you know, dem don scata my house, and now-now-now dem don tear my curtains to pieces.
21. How long must I see di war flags, con hear di trumpets of war?
22. “Becos my pipo na mumu pipo, dem neva sabi me, dem be mumu pikin wey no get understanding. Na only wrong tin dem get sense to do, but dem no sabi how to do beta tins!” naso Baba-God tok.
23. I look di earth, and I see sey e dey anyhow, and e empty. And di heavens no get light.
24. I look di mountains plus di hills, and I see sey dem dey shake anyhow and dem dey move.
25. I look, and I see sey no man dey, and all di birds of heaven don fly komot.
26. I look, con see sey all di green-land don turn to desert, and all di cities wey dey there don scata kpatakpata for Baba-God front, and as he dey vex seriously.
27. Becos na wetin Baba-God tok be dis, “Di whole land go scata, but I no go scata am kpatakpata.
28. Di earth go cry becos of dis tin, and di heavens wey dey for up-up go turn to black; becos I don tok am, I don arrange am, and I no go change my mind, or turn back from am.
29. Di whole city go run, becos of di noise of di horse-riders and di men wey dey shoot arrow, di pipo go run wit fear. Dem go kpanji [hide] for inside bush, con climb on top of rocks. All di cities go empty, and no single pesin go remain for there!
30. Wetin una go do, wen dem don rob una? Even though una dey wear fine red cloth, con wear gold jewelry, even though una do make-up for face? Una just dey make unasef fine for notin. Your boyfriends (di kontris wey be your padi) go fashi you, dem dey plan to kill you sef.
31. Becos I don hear voice like woman wey dey feel pain as she wan born her first pikin, di voice of di daughter of Zion wey dey cry, con spread her hand, “Wahala for me now! Becos my soul don taya as dem dey kill me!”
23 Comments
Isaac Perry
Amazing! This blog looks exactly like my old one! It’s on a completely different subject but it has pretty much the same layout and design. Superb choice of colors!
tetracycline antibiotics for acne
Hi there, I check your blog like every week. Your writing style is witty, keep up the good work!
wellbutrin classification
I just couldn’t depart your web site prior to suggesting that I actually loved the usual info an individual provide for your guests? Is going to be back continuously to investigate cross-check new posts
zovirax 5% ointment
There is definately a great deal to know about this subject. I love all the points you’ve made.
what family is erythromycin
You could definitely see your expertise in the work you write. The arena hopes for even more passionate writers such as you who aren’t afraid to mention how they believe. Always go after your heart.
rifampicin inducer
Ahaa, its pleasant conversation regarding this paragraph at this place at this webpage, I have read all that, so now me also commenting at this place.
ivermectin otc tennessee
Ahaa, its pleasant conversation regarding this piece of writing at this place at this web site, I have read all that, so now me also commenting at this place.
doxycyclin
Thank you for the good writeup. It in fact was a amusement account it. Look advanced to far added agreeable from you! By the way, how can we communicate?
tadalafil teva
I’ll immediately grasp your rss feed as I can’t find your email subscription hyperlink or newsletter service. Do you’ve any? Kindly allow me know in order that I may subscribe. Thanks.
clozapine echocardiogram
Incredible! This blog looks exactly like my old one! It’s on a totally different topic but it has pretty much the same layout and design. Excellent choice of colors!
udenafil
I just couldn’t go away your web site prior to suggesting that I extremely loved the usual info an individual supply on your guests? Is going to be again frequently to check out new posts
sildenafil mechanism of action
There’s certainly a lot to learn about this topic. I love all of the points you made.
cheap viagra overnight delivery
I see your site needs some fresh & unique content. Writing manually is time consuming, but there is solution for this. Just search for: Masquro’s strategies
famotidine injections
I’m not that much of a online reader to be honest but your sites really nice, keep it up! I’ll go ahead and bookmark your site to come back in the future. Many thanks
rabeprazole sodium 10 mg
Hi, I do believe this is an excellent blog. I stumbledupon it 😉 I am going to come back once again since I bookmarked it. Money and freedom is the greatest way to change, may you be rich and continue to help other people.
classification of zantac recall
I enjoy what you guys are up too. Such clever work and coverage! Keep up the awesome works guys I’ve included you guys to my blogroll.
furosemide 40 mg
These are truly fantastic ideas in about blogging. You have touched some pleasant points here. Any way keep up wrinting.
generic cialis
I am sure this article has touched all the internet users, its really really good article on building up new webpage.
esomeprazole 40mg
I am sure this article has touched all the internet people, its really really pleasant article on building up new weblog.
buy amoxicillin
I am sure this paragraph has touched all the internet viewers, its really really nice piece of writing on building up new blog.
fluconazole medication
Ahaa, its good dialogue concerning this piece of writing at this place at this webpage, I have read all that, so now me also commenting at this place.
cenmox
Hi, I do think this is a great blog. I stumbledupon it 😉 I will revisit yet again since i have bookmarked it. Money and freedom is the best way to change, may you be rich and continue to help other people.
levothyroxine pill
You’ve made some good points there. I checked on the internet to find out more about the issue and found most people will go along with your views on this site.