Job Chapter 11
Zophar Change-am-for Job
- Zophar wey be di Naamathite con ansa sey,
- “Abi dem no suppose ansa your plenty tok? And becos man dey tok plenty tok con mean sey e dey correct?
- Abi your empty tok go make men shut up? Abi wen you dey tok anyhow, abi make no pesin correct you?
- See, you don tok sey, “My ways dey pure and I dey clean for Baba-God eyes.”
- But I wish sey Baba-God fit tok, and make he open hin lips against you,
- Make he show you di secrets of wisdom—wisdom na double of wetin dey [wisdom no be small mata]. Listen, Baba-God dey punish you small—pass di punishment wey you suppose get!
- Abi you fit understand Baba-God finish if you fyne am? You fit sabi everitin finish—about Baba-God Almigthy?
- E high like heaven; wetin you fit do? E deep pass hell; wetin you fit sabi?
- Di measurement long pass di earth, and e wide pass di big-river.
- If Baba-God come put pesin for prison, or drag pesin go court, who fit stop am?
- Becos he know fake-pipo, he dey see dia wickedness sef; abi he no dey reason am?
- Becos mumu men only fit get-sense, wen wild donkey fit born pikin wey be like human being.
- If you prepare your heart and you stretch your hand to am;
- If sin dey for your hand, carry am go far-far, and no let wickedness dey for your house.
- Na den you go fit raise your innocent face; yes, you go stand strong gidigbam wit no fear:
- Becos you go forget your sorrow, and dem go komot like water wey dey flow go.
- Your life go clear pass afta-noon, you go shine, and you go be like morning.
- You go dey secured becos hope dey. You go look round yousef wit protection, and you go rest wit safety.
- You go lie down and no pesin go make you fear, and plenty pipo go make deal wit you.
- But wicked pipo eyes go close, and dem no go fit escape—and dia hope go be like pesin wey dey kpeme.