Job Chapter 13
Job Defend Hinsef
- See, my eyes don see all dis tins, my ears don hear, con understand am.
- Wetin you know nahin mesef know, my levels no low pass you.
- Surely I go follow di Almighty tok, and I wish to reason wit Baba-God.
- But una dey form lies, una be healer wey no get value.
- I wish sey all of una fit just keep quiet! Na di wise tin wey una fit do.
- Hear my reasoning now and listen to di beg wey my lips dey beg.
- Abi una go tok in a wicked way for Baba-God, con yarn in a wayo way for am?
- Abi you dey try to defend Baba-God? Abi you go fight for Baba-God?
- If Baba-God torch-light you, he go see any beta tin? Abi you tink sey you fit whyne Baba-God as una take dey whyne odas?
- True-true, he go change-am-for you, if you codedly do partiality.
- Abi hin levels as king no go make your mind-cut? Abi hin fear no go fall on you?
- Una proverbs useless like ashes, and una argument soft like clay.
- Make una chill, make una leave me, so dat I go fit tok, and make anytin wey wan happun—happun.
- Why I dey put mysef for risk, con dey put my life for my hands?
- Even though he nack me, but I go still trust am: but I go maintain my own ways for hin front.
- Na hinsef go save me: becos fake-pesin no fit stay for hin front.
- Calm down, hear my word and wetin I dey yarn wit your ears.
- See, now wey I don arrange my case, I know sey Baba-God go confam me as innocent.
- Abi any pesin fit tok sey I dey guilty? If na so, I go dey silent and I go die.
- Only do dis two tins for me, so dat I no go dey hide from you:
- Carry your hand far from me, and no let di fear wey I get for you—make my heart dey cut.
- Den wen you call, I go ansa: or make I tok, and make you ansa me.
- How many be my bad-bad ways plus my sins? Make me know di bad-bad ways plus my sin.
- Why you dey hide your face, con dey reason me like enemy?
- Abi you go break leaf wey dey move upandan? Abi you go dey pursue dry grass?
- You dey write bitter tins against me for book, even di bad-bad-tins wey I do wen I be youth.
- You don tie my legs wit chains, you dey watch my ways well-well, and you dey calculate my steps.
- Naso man dey waste go like sometin wey don rotten, like cloth wey moth [insect] don chop.