Job Chapter 20
Zophar Preaching About Wicked Man
- Zophar di Namathite ansa, con tok sey,
- “So my reasoning nahin make me ansa you, becos di tin dey disturb me for heart.
- I don hears as you dey throway insult, and my understanding dey ginger me to ansa you.
- Abi you no know dis tin from olden days, since wen Baba-God put man for di earth,
- wicked man victory no dey last, and di happiness of evil pipo no dey last at all?
- Even though hin levels long reach heaven, and hin head dey touch di clouds;
- But he go kpeme forever like hin own shit [wey dem throway]; pipo wey bin see am before go tok sey, “Where he con dey?”
- He go fly komot like dream, and dem no go see am again. Yes, he go run komot like vision for night.
- Di eyes wey bin see am no go see am again; and he no go fit live for hin house again.
- Hin pikin go favour poor pipo, and hin hands go give back to poor pipo.
- Hin bones brekete wit di pawa of hin youth, but e go follow am enta grave.
- Even though wickedness bin sweet for hin mouth, even though he bin hide am under hin tongue;
- Evil sweet for dia mouth well-well sote dem keep some for hin mouth to enjoy di taste.
- But naso di food for hin belle con dey worry am, e con be like snake poison for hin belle.
- He bin swallow riches, and he go vomit dem back; Baba-God go push am komot from hin belle.
- He go suck di poison of cobra, viper nahin go kill am.
- He no go see di rivers, di plenty-water, and di river wey dey flow wit honey plus butter.
- He go return wetin he work for, and he no go fit swallow am; he go return dem based-on wetin he gon gada, and he no go happy about am.
- Becos he don oppress and fashi poor pipo, becos he don use gragra take collect house wey he no build;
- Becos hin heart go dey worry am (becos of longatrot), he no go fit save di tins wey hin eyes dey shuuk for.
- He no fit chop-remain; so hin moni no go last.
- Wen he don dey prosper yanfu-yanfu nahin wahala go jam, and sorrow go fall am.
- Wen he wan just wan chop bellefull—nahin Baba-God go vex for am like faya, and Baba-God go send hin vex like rain to am as he dey chop.
- He go try to run from iron weapon, but bronze arrow go shuuk am.
- Dem go komot di arrow from hin back, and di arrow head go dey shine wit blood. Gbege dey for hin head.
- Na inside darkness all hin beta-beta-tins go dey. Faya wey no be man light—nahin go burn am, and e go burn any pesin wey remain for hin house.
- Di heaven go show hin sin, and di earth go dey against am.
- Di yanfu-yanfu wey he get for hin house go komot, and hin beta-beta-tins go flow komot for di day wen Baba-God dey vex.
- Na dis be di portion wey Baba-God don give wicked man, and hin destiny wey Baba-God don sign for am.