Job Chapter 21
Job: Baba-God Go Punish Wicked Pipo
- But job ansa, con tok sey,
- “Make una hear me well, na di only tin wey una fit do to make me cool down.
- Make una just let me tok, and afta I don tok finish, una fit kontinu to dey yab me.
- As for me, abi my complain na to man? And if na so e be, why my spirit no go dey worry?
- Make una look me, and make una shock. Put your hand for your mouth wit surprise.
- Wen I tink about wetin I dey tok, e shock me, and my body dey shake.
- Why wicked pipo dey live long, and dem dey prosper wit pawa?
- Dia pikin stand gidigbam as dem dey see dem, and dia pikin dey grow for dia front.
- Dia house dey safe from fear, and Baba-God no dey punish dem wit gbege.
- Dia malu dey always born. Dia malu dey born pikin and dem no dey lose dia pikin.
- Dia pikin dey play upandan like sheep-pikin,
- dem dey dance di music of sheke-sheke and harp [music instrument wey ge strings], and dem dey dance to di sound of flute.
- Dem dey spend dia days like ajebuta, and dem go enta grave wit peace.
- So wicked man go tell Baba-God sey, ‘Komot from us becos we no wan sabi your ways.
- Who be di Almighty wey we go dey serve am? And wetin we go gain if we dey pray to am?’
- Dem dey claim to succeed wit dia own pawa; but I no fit follow dia way of reasoning.
- How many times wicked pipo light dey ever off? How many times kasala ever burst on any one of dem? Abi Baba-God don ever scata wicked pipo or punish dem wit palava as he dey vex?
- con blow dem komot like chaff for breeze? Or like dust wey heavy-breeze dey blow komot?
- Una go tok sey, ‘See, Baba-God go punish di pikin for dia papa sins!’ But make Baba-God punish di pipo wey do bad bad tins, so dat dem go fit understand hin judgement.
- Hin korokoro eyes go see as he go take scata, and he go drink inside di vex of Baba-God Almighty.
- Abi he go care about wetin happun to dia family afta dem don die—wen di numba of hin months don cut komot?
- Abi any pesin fit teach Baba-God anytin? As una dey see sey he dey judge pipo wey get levels.
- Some pipo go strong till dem die, dem dey die as happy pipo wit peace,
- Wit hin fresh body, and hin bones strong and fresh.
- And anoda man go die wit sadness inside hin spirit, and he no get chance to chop-life.
- Naso dem go lie down togeda for dust, and worms go cover dem.
- See, I know una tinking, and di wrong tins wey una dey reason against me.
- Una tok sey, “Where di prince house dey now, and where wicked pipo house dey now?”
- Una neva ask di pipo wey dey travel around? Abi una no reason wetin dem yarn?
- See Baba-God dey keep wicked pipo for di day of scata-scata, and dem go dey to face di day wen Baba-God dey vex?
- Who fit tell am face-to-face, sey wetin he dey do no good, or pay am back for everitin wey he don do?
- But he go enta grave, for grave wey dem dey guard.
- Plenty pipo go follow di pipo wey dey go bury am, and di ground for bottom-of-di-mountain go happy to cover hin body.
- How una wan take cool me down wit empty words, since una ansa no be true?”