Job Chapter 23
Job Want Baba-God
- So Job ansa, con tok sey,
- “Even today my complain dey bitter, hin hand heavy on me, upon all my cry-cry.
- How I wish sey I know where I fit meet am, so dat I go fit near where he sidon put.
- I go tell am my case for hin front, and I go full my mouth wit arguments.
- I go know di words wey he go ansa me, con understand wetin he go yarn me.
- Abi he go change-am-for me wit hin ogbonge pawa? No, but he go listen to me.
- Na for there honest pipo fit reason wit am, so my judge go free me forever.
- See, I go front [for east], but he no dey for there, and I go back [for west], but I no see am for there.
- Wen he turn go my left [for north], I no see am for there; wen he turn go my right [for south] side, I no still see am for there:
- But he know di road wey I dey waka pass; wen he don test me, I go see sey I pure like gold.
- My leg don hold hin steps, I don keep hin way, and I no go turn komot.
- I no turn back from di commandment of hin lips; I value di words from hin mouth pass di food wey I need.
- He no dey change, so who fit change hin mind? Anytin wey he wan do nahin he dey do.
- He dey do di tins wey he don plan for my life, and plenty of dis kain plans dey wit am.
- Nahin make my body dey shake for hin front, wen I reason am—I dey fear Am.
- Baba-God don make my heart soft, and di Almighty dey make me fear;
- Darkness dey round me, and he no hide deep darkness from my face.