Job Chapter 25
Bildad: Man No Fit Dey Good
- Bildad di Shuhite ansa, con tok sey,
- “Baba-God get pawa to rule, and pipo dey fear Am, he dey make peace for di heavens.
- Who fit count di armies of heaven? Abi hin light no dey shine on di whole earth?
- How man go con get cean-heart for Baba-God eyes? Or how pesin wey woman born—fit holy for Baba-God eyes?
- For hin eyes—even di moon no bright, and di stars no pure for hin eyes; becos he dey shine pass dem.
- Tokless of man wey be worm? And man pikin wey be ordinary worm?