Job Chapter 26
Job: Who Fit Understand Baba-God Levels As King
- But Job ansa con tok sey,
- “See as you take epp pesin wey no get pawa! See as you take save di hand of pesin wey no strong!
- How you take advice pesin wey no get wisdom? and how many wise advice you don give?
- Where you take get all dis words of wisdom? Which spirit dey ginger you to tok like dis?
- Di spirit of di dead dey shake under di water, and even those wey dey for there.
- Di world of di dead and scata-scata dey open to Baba-God, notin dey block hin eyes from seeing am.
- Baba-God stretch out di north sky to hang for on top of di empty spaces, and he hang di earth for air.
- He dey wrap di rain for hin thick cloud, and di clouds no dey burst wit di weight.
- He dey hide di face of hin king-chair [full moon], and he dey spread hin cloud take cover am.
- He draw round line on top of di water, for di place where di night and day take meet.
- Di pillars of heaven dey shake, and dem dey fear wen Baba-God halla for dem.
- He dey ginger di big-river wit hin pawa, and by hin understanding—he break di strong-breeze.
- Hin Spirit make di heavens fine well-well. And hin hands shuuk di sharp snake wey wan move.
- True-true all dis na di smallest tins wey Baba-God fit do, na just di smallest of hin pawa. Who con fit understand di thunder of hin pawa?”