Job Chapter 30
Job Levels Turn To Poverty
- But now, di pipo wey I senior dey yab me, pipo wey I for no even let dia papa epp di dogs wey dey guard my sheep.
- Who dia hand fit epp me, those pipo wey no get pawa again?
- Dem don thin finish becos of hunger plus poverty, dem dey waka round dry land, and inside empty desert for night.
- Dem dey pluck wild fruits from bush and dem dey chop di roots of broom tree as food.
- Dem drive dem komot from among men, and pipo dey shout follow dem as if dem be tiff.
- So dem con go stay for hole for bottom-of-di-mountain, and for inside rocks and holes for ground.
- Dem dey make noise like donkeys wey dey shout for bush, and dem dey gada togeda among under shuuku-shuuku grass.
- Dem be pikin of mumu; yes, dem be pikin of gbanjo men—men wey dem don pursue from di land.
- And now dem dey yab me wit bad songs! Dem dey whyne me!
- Dem hate me, dem dey run far from me, and dem get liver to spit for my face.
- Becos he don loose di wire for my bow and arrow, and he don wound me; dem don cut-chain—so dem no dey fear to turn against me anyhow for my front.
- Jaguda pipo attack me from my right; dem push my leg komot, and dem dey raise dia ways of scata-scata against me.
- Dem scata my road; dem do everitin to scata me; and no pesin dey to stop dem.
- Dem dey enta me like water wey dey break my wall, dem dey jump on me from di wall wey don scata.
- Kasala don face me. Dem dey pursue my soul like strong-breeze, and my beta-beta-tins don vanish like cloud.
- Now my soul don pour out on me.; di days of suffer-head don hold me.
- My bones dey shuuk me for night, and di pain wey dey bite me no dey rest.
- Wit di seriousness of my disease nahin my cloth [skin] take wor-wor. E tie me round like di collar of my cloth.
- He don throway me for portor-portor, and I don turn to dust plus ashes.
- I cry to you but you no hear me. I stand up but you no-send me.
- You don dey show me wickedness, you don use your strong hand take change-am-for me.
- You don carry me give heavy-breeze, you make me roll inside am, con spoil my success.
- I know sey you go carry me meet death, and to di house wey all men must enta.
- Surely no pesin go turn againts pesin wey need epp, wen dem cry for epp inside dia palava.
- Abi I no cry for di pipo wey dey face wahala? Abi my soul no feel sad for poor pipo?
- Wen I fyne beta tin but evil—nahin come meet me; and wen I wait for light—nahin darkness come meet me.
- My belle con dey boil and e con dey worry me, di days of suffer-head face me.
- I start to dey cry about, wit no sun: I stand up con dey cry for epp for where di pipo gada.
- I be di broda of dragons, and owls na my padi.
- My skin don black for my body, and my bones don burn wit heat.
- My harp [music instrument] con dey cry, and my flute dey play music for pipo wey dey cry.