Job Chapter 31
Job Defend Hin Pure-heart
- I don make agreement wit my eyes, why I go con dey reason woman?
- Which portion from Baba-God dey for there from up-up? And which share I con receive from di Almighty from up-up?
- Abi scata-scata no dey for wicked pipo? And strange punishment for pipo wey dey do bad-bad-tins?
- Abi he no dey see my ways, con count all my steps?
- If I don waka inside fake-life or my leg don rush to do mago-mago;
- Make Baba-God weigh me for scale wey balance, so dat he go see my clean-heart.
- If my steps don turn komot from di way, and my heart dey follow wetin dey make my eyes dey shuuk, or if my hand no gree komot from bad-bad-tins,
- den make I plant, and make anoda pesin chop am. Yes, make my pikin cut komot from dia root.
- If woman don whyne my heart, or if I don hide dey wait for my neighbour door,
- Den make my wife grind and cook food for odas, and make oda men climb her.
- Becos dis na wicked crime; yes, na bad tin wey di judges go punish pesin for.
- Becos na faya wey dey burn tins finish, and wey go komot all my plenty beta tins.
- If I don do anyhow to my horse-boy or my house-girl wen dem kwanta wit me;
- Wetin I go con do wen Baba-God go raise up? And wen he visit me, wetin I go tell am?
- Abi no be Baba-God wey make me for my mama belle nahin make am? Abi no be di same God make us for awa mama belle?
- If I don stop poor pipo from getting wetin dem really want, or I don blind di eyes of widow,
- Or if I don chop alone, and I no let pipo wey no get papa chop wit me,
- becos from wen I small, I take care of pipo wey no get papa like sey I be dia papa, and I don take care for widows all my life.
- If I don see pesin dey die becos e no get cloth to wear, or any poor pesin wey no get cloth;
- Abi he no bless me, abi di wrapper wey I provide no make am warm?
- If I don carry hand against pipo wey no get papa, wen I see sey I get connection for court;
- den make my hand fall from my shoulder bone, and make my hand break from di bone.
- Becos I dey fear scata-scata from Baba-God and hin big levels, so I no fit do those kain tins;
- If I don put my hope on gold, or If I don tell fine gold sey, ‘Na you I dey trust,’
- If I don dey praise mysef becos I get plenty moni, and becos my hand don get yanfu-yanfu;
- If I don see di sun as e dey shine [as sometin wey I dey worship], or di moon dey move wit brightness;
- And if my heart don codedly whyne me to worship dem, by kissing my hand to show respect for dem;
- Dis one sef na bad tin wey di judges suppose punish; dat mean sey I for don deny di God wey dey for up-up.
- If I don happy for di scata-scata of di pipo wey hate me, or celebrate wen evil meet am;
- And I neva commit any sin by cursing pipo wey hate me.
- My servants neva ever tok sey, ‘Who fit see pesin wey neva chop belleful from hin meat’?
- I neva ever pursue stranger komot enta street, but I open my doors to pipo wey dey travel pass.
- Abi I don cover my sin like Adam by hiding my sins for my heart?;
- Becos I dey fear plenty pipo, or di hate from families make me fear, sote I con keep quiet and I no komot from my door?
- How I wish sey pesin fit hear me! See, wetin I want from my heart na make Baba-God hear me, and make di pesin wey dey put mata for my head—write my case for book.
- I go surely carry am for my shoulder, con wear am like crown.
- I go count all my steps for am, and I go come meet am like prince.
- If my land dey cry against me, and if all di long line of sand wey I gada to farm—dey cry against me togeda;
- If I don chop fruits wey I no pay for, or if I don make di owners lose dia life;
- Make shuuku-shuuku grow instead of wheat, and make grass grow instead of barley. Di words of Job don end.