Job Chapter 33
Elihu Change-am-for Job
- “But now, oh Job, biko hear my word, and listen to all my yarnings.
- See, now I don open my mouth, my tongue don tok for inside my mouth.
- I go tok from my clean-heart, and my lips go tok knowledge wey clear.
- Baba-God Spirit nahin make me, and di breath of di Almighty nahin give me life.
- If you no fit ansa me, arrange your word, con argue your mata wit me.
- See, I just be like you for Baba-God eyes; na from clay sef Baba-God make me.
- So you no get any reason to fear me, and I no go put any pressure on you to push you down.
- Surely, you don tok for me to hear, and I don hear di voice of your word wey you tok sey,
- ‘I dey clean wit-out sin, I dey innocent and bad tins no dey inside me.
- But Baba-God dey fyne excuse to attack me, and he dey count me as hin enemy.
- He tie chain for my leg; he dey watch everi move wey I make.’
- But I dey tell you Job, you dey wrong. I go ansa you sey Baba-God great pass any human being.
- Why you dey kwanta wit Baba-God sey he no dey ansa your complains?
- Becos Baba-God tok onces, and twice, but man no still understand am.
- For inside dream, for inside vision for night, wen deep sleep dey catch men, and wen dem dey roll for bed;
- Na den Baba-God dey open men ears, and he dey close dia ears wit hin messages,
- So dat he go stop man from hin own plan, and make man stop to dey feel-big.
- He dey hold hin life so dat he no go fall inside pit, and he dey hold hin life make sword no kill am.
- Baba-God dey correct man wit pain for bed, and all hin bones dey feel strong pain,
- sote he go hate food, and even di finest food no hungry dem.
- Hin flesh don dry finish, sote dem no fit see am, and hin bones wey dem no fit see con dey show from hin body.
- Yes, hin soul dey shift go grave, and hin life dey shift go meet scata-scata.
- “But if angel from heaven show-face—special messenger, one among thousands, wey remind man of wetin dey right for am.
- He go show grace, con tok sey, ‘Save am from grave, becos I don see payment to save hin life.’
- Hin skin go fresh pass small pikin skin; he go be like wen he still be youth.
- He go pray to Baba-God, and Baba-God go favour am, and he go see hin face wit happiness, becos he go give man hin goodness.
- He dey look men, and if any one tok sey, ‘I don commit sin, I change di right tin, and I no gain anytin.’
- He go save hin soul from grave, and hin life go see light.
- “Yes, Baba-God dey do all dis tins for pipo everi time,
- to save dem from grave, and to show dem di light of life.
- Hear me well, oh Job. Listen to me, dey quiet, and I go tok.
- But if you get anytin to tok, ansa me, carry-go; becos I wan confam sey you dey right.
- But if not, den listen to me. Keep quiet and I go teach you wisdom!”