Job Chapter 35
Elihu Remember Job About Baba-God Justice
- But Elihu tok, con yarn sey,
- “Abi you tink sey wetin you don tok dey right—sey, ‘My clean-heart pass Baba-God own?’
- Becos you tok sey, ‘Wetin I go gain, and wetin I go gain if I dey pure wit no sin?’
- I go ansa you plus all your padi wey dey wit you.
- Look di heavens and make you see, and look di clouds wey high pass you.
- If you commit sin, wetin you do against am? Abi if you start to do more-more bad-bad-tins, wetin you dey do to am?
- If you get clean-heart—wetin dat one con give am, or wetin you put for hin hand?
- No, your sins dey affect only pipo wey be like you, and your good works dey only affect human being.
- Pipo dey cry out becos dem dey oppress dem well-well. Dem dey cry under di pawa of strong men.
- But no pesin dey ask sey, “Where Baba-God wey make me, wey dey give songs for night;
- Wey dey make us get-sense pass animals, con make us wise pass di birds for sky?
- Dem dey cry for there, but no pesin ansa dem, becos evil men dey feel-big.
- Surely, Baba-God no go listen to dia empty cry, and di Almighty no-send dem.
- Tokless of wen you tok sey you no dey see am, but justice dey for hin front and you must wait for Am.
- And to add-join, you tok sey—becos he neva punish as he dey vex, and wickedness of pipo no concern am.
- But you dey tok yeye tins, Job. You dey tok plenty tok like olodo.”