Job Chapter 36
Elihu Show Baba-God Justice Plus Pawa
- Elihu still tok sey,
- “Make una just listen small, and I go show una sey e get plenty tin wey I wan tok for Baba-God.
- I go fetch my knowledge from far-far, and I go use wetin I sabi take show sey Baba-God wey create me—get clean-heart.
- True-true my words no be lie; pesin wey dey perfect for knowledge dey wit una.
- See, Baba-God great, and he no hate any pesin, and he be ogbonge for strength plus wisdom.
- He no dey save wicked pipo life, but he dey give poor pipo dia right.
- He no dey komot hin eyes from pipo wey get clean-heart, but he make dem sidon wit kings for king-chair. Yes, he go make dem stand gidigbam forever, and he dey carry dem up forever.
- And if dem tie men wit rope, or hold dem wit chain of wahala,
- he dey show dem wetin dem don do plus dia sins—sey dem dey do anyhow
- He dey open dia ears sef for correction, con command sey make dem komot from bad-bad-tins.
- If dem obey, con serve am, dem go spend dia life inside prosperity, and dem go spend dia years dey flex.
- But if dem no gree obey, na sword go kill dem, and dem go kpeme wit-out knowledge.
- But fake-pipo dey carry mata for mind; and dem no dey gree pray for epp, even wen BabaGod punish dem.
- Dem dey die for young age, and dia life dey among pipo wey no clean.
- But Baba-God dey save poor pipo inside dia suffer-head, and he dey open dia ears wit suffer-suffer.
- Job, Baba-God dey carry you komot from kasala, con carry you go big space where peace dey, and na beta-beta food he dey arrange for your table.
- But you brekete wit di judgement of evil pipo, so judgement and justice don hold you.
- Dey careful becos vex dey, or he go nack you wit one blow, and even plenty payment no go fit save your life.
- Abi all your moni or all your works protect you from wahala?
- No wish make night reach, wen pipo dey cut komot [vanish] from dia places.
- Watch yoursef, so dat you no go dey reason evil tin, dis suffer-head na to keep you from evil life [becos you don dey complain about Baba-God].
- See, Baba-God nahin get pawa pass, who sabi teach like am?
- Who fit teach am for hin way? Or who fit tok sey, ‘You don do bad tin?
- Remember to give hin work levels, wey men don praise for inside songs.
- Everi pesin don see dis tins, even if na from far-far.
- See, Baba-God na ogbonge, and we no fit know am finish, and we no know how many years he be.
- Nahin dey draw di water from di earth put for cloud, con turn am to rain.
- Baba-God dey let di clouds dey drop wit rain, con pour plenty rain for men.
- Abi any pesin fit understand how di cloud take dey spread, or di thunders wey dey roll from heaven?
- See as he spread hin lightning around di sky, and he dey cover bottom of di big-big-river.
- Na wit dis ogonge works he take dey judge di pipo, and he dey give dem food brekete.
- He dey full hin hand wit tunder bolts, and he dey shoot am to wetin he target.
- Di voice of thunders dey tok sey he don show-face; even malu dey make sound wen e wan show-face.