Job Chapter 38
Baba-God Face Job
- Naso Baba-God ansa Job from inside di rolling-breeze, con tok sey,
- “Who be dis wey dey question wisdom wit empty tok like olodo?
- Now hold your body strong like man, and ansa di questions wey I dey ask you.
- Where you dey wen I set di foundations of di earth? Tell me if you get di understanding.
- Who measure di shape of di earth, abi you know? Or who draw di line to measure di earth?
- Wetin dey hold di pillars of di earth, or who set di foundation stone,
- Wen di morning stars sing togeda, and di sons of Baba-God shout wit happiness.
- Or who close di gate of di big-river, make e no enta land, wen water burst from di belle of di earth?
- Na me cover di water wit cloud, con wrap am wit darkness.
- I mark di boundary of di water, and I lock am for gate make e no cross e place.
- I tok sey, “You don reach di place wey far, and na for here you go stop!’
- “You don ever command di morning to show-face, and make di sun to rise from di east,
- So dat di light of di day go spread reach di ends of di earth, and so dat wickedness go shake komot?
- Di earth go form like clay wey dem press under seal; e parts show like di design of cloth
- Wicked pipo light go off, and hin hand wey he raise up go break.
- You don enta di place wey di water of di big-river dey flow from? Abi you don enta di deep-deep water?
- Abi you sabi where di gates of death dey? Abi you don see di gates of deep darkness?
- Abi you sabi where di earth wide reach? Tell me about am if you sabi everi-everi!
- Abi where light dey come from, and where darkness dey go?
- You fit carry dem go dia territory? You sabi di road reach there?
- Abi you sabi am, becos dem born you dat time and becos you old well-well?
- Abi you don visit di place where di stores of di snow dey, or see di store of ice-stones?
- I don keep dem as weapon for di day of kasala, for di day of fight and war.
- Where di road of where di lighting dey live? Or you sabi where di east breeze take dey from blow round di world?
- “Who make way for di big-water [of di heavy rain] to overflow, who set di way of di lightning of thunder;
- to make rain fall for dry land, for inside dersert where no pesin dey live;
- to water empty desert land, con make di small grass grow?
- “Abi rain get papa? Who dey born dews?
- Who be di mama of ice? Who dey born di ice-dust from heaven?
- Becos water dey turn to ice wey strong like rock, and di face of di river go freeze.
- “Abi you fit tie di chains of Pleiades* or loose di belt of Orion* (Pleiades and Orion na group of stars)?
- Abi you fit direct di group of stars tru dia seasons, or guide di Bear* wit her satelites?
- Abi you sabi di laws of di heaven? You fit use dem take control di earth?
- Abi you fit shout to di clouds to make rain fall cover you?
- Abi you fit make lightning show-face, con make am strike where you want?
- Who dey put wisdom for pesin mind, and understanding for pesin heart?
- Who wise reach to count all di clouds? Who fit pour di bottles of heaven,
- Wen di dust don dey dry and strong, and di thick sand wey don form togeda con dey gum demsef [becos of heat]?
- Abi you fit hunt bush meat for lion, con make di young lions belleful,
- as dem dey lie down for dia joint or hide for forest?
- Who dey provide food for di raven [wild bird] wen dia pikin cry to Baba-God, con dey fly upandan wit hunger?