Job Chapter 4
Eliphaz Correct Job
- Naso Eliphaz di Temanite ansa, con tok sey,
- “If we try to rub-mind wit you, you go feel sad? But who fit stop hinsef from yarning?
- See, you don teach plenty pipo and you don give pawa to pipo wey no get strong hand.
- Your words don hold pipo wey dey fall, and you don ginger di knees wey no-strong.
- But now all dis tins don happun to you and you dey shake, e don touch you and you dey worry.
- Abi your fear of God no dey give you full-mind? Abi your clean-heart plus your pure mind no dey give you hope?
- “Reason am! Tell me any time wey you don see innocent pesin die? Or where man wey get clean-heart fall?
- I don see, pipo wey dey plant farm of sin, and wey dey plant wickedness—and dem dey harvest di same tin.
- Dem kpeme wen Baba-God breath, and dem scata wen he kabash wit vex.
- Lion wey dey halla, and di voice of rugged lion, plus di teeth of young lion—dey break.
- Di old lion dey kpeme becos e no see animal catch, and strong lion-pikin go scata.
- “E get one secret wey I hear, as if pesin tok-small-small for my ear.
- E come meet me for one vision for night and e make me fear, wen pipo don sleep go far.
- Fear catch me, and my mind cut—sote all my bones con dey shake.
- Naso one spirit pass front of my face; and di hair wey dey for my body con stand up.
- Di spirit stand for one place, but I no fit understand wetin e be: one image con dey for my eyes, everi where silence, so I hear one voice wey tok sey,
- “Abi man wey no dey live forever fit get clean-heart pass Baba-God? Abi man fit pure pass who make am?
- See, he no trust hin servants, and he dey correct di error of angels:
- Tokless of men wey Baba-God make wit clay, wey dia foundation dey for dust, and wey dey die like moth [insect]!
- Dem dey alive for morning and by evening dem don kpeme. Dem go die like dat—and no-pesin go even reason am.
- Abi dia levels no dey cut like rope of tent? And dem dey die wit-out wisdom [like olodo].’