Job Chapter 5
Eliphaz Kontinu
- Call now, if any pesin dey wey go ansa you; and to which of di saints you go turn to?
- Vex dey kill mumu man, and envy dey kill swegbe.
- I don see mumu dey grow from hin root, but before you know I curse hin house.
- Hin pikin dey far from safety, and dem go kpeme for di gate, and no pesin dey to save dem.
- Hungry pipo dey chop hin harvest, and dem dey komot am—even wen shuuku-shuuku dey round am, and pipo dey set trap for di moni.
- Even though suffer-head no dey come from dust, or sey wahala dey show-face from ground;
- Still, dem born man enta palava—just as spark take dey fly go up from faya.
- I go fyne Baba-God, and I go put my business for Baba-God hand;
- Baba-God wey dey do ogbonge tins, tin wey no pesin fit understand, and plenty wonderful tins wey pesin no fit count.
- Wey dey pour rain for di earth and wey dey send water for di land—
- to carry low-key pipo [poor pipo] go up, so dat those pipo wey dey feel sad go go up for where dey safe.
- He dey fall di hand of pipo wey dey plan evil tins, sote dia hand no fit do dia business.
- He dey catch wise pipo inside dia own wiseness, so dat di plans of wayo pipo go sharply spoil.
- Dem meet darkness for day time, and for afta-noon—dem dey waka like pipo wey no dey see for night.
- But he dey save poor pipo from sword, from dia mouth and from di hand of strong pipo.
- So dat poor pipo go get hope and wickedness go close e mouth.
- See, di man wey Baba-God dey correct na happy man; so make you no hate wen Baba-God Almighty dey correct you.
- Even tough he dey wound, he still dey bandage pesin. He fit nack pesin, but hin hand still dey heal pesin.
- He go save you from six kasala; yes, he go even save you from di seventh one, and he go protect you from evil.
- Wen hungry dey for town—he go save you from death, and for war time—he go save you from di pawa of di sword.
- You go dey safe from bad-mouth, and you no go dey fear wen scata-scata show-face.
- Wen hunger and scata-scata dey for town—you go dey laff, and you no go fear di wild animals of di earth.
- You go get peace even wit stone for field, and even di wild animals go get peace wit you.
- You go know sey your house dey safe. Wen you enta your house and notin go dey miss.
- You go know sey your pikin go brekete, and your pikin go grow like grass of di earth.
- You go enta grave wen you don live your full life, like corn wey dem gada from harvest for di correct time!
- “We don read life and we don see sey all dis tins na true. Listen to my advice and make you use am for your life.”