Lamentation Chapter 5
Prayer For Mercy
- Oh Baba-God, remember wetin don happun to us; reason, and make you see awa disgrace.
- Foreigners don collect awa land and properties, and awa house dey wit foreigners.
- We don turn to pipo wit-no mama and papa, awa mama don turn to widows.
- We must buy di water wey we dey drink; and we dey buy awa own wood.
- Those wey dey pursue us dey for awa neck, we don taya, but dem no let us rest.
- We carry awasef give Egypt and Assyria so dat we go fit get food to survive.
- Awa papa-papa-papa commit sin and dem no dey again, and we dey face dia punishment.
- Slaves dey rule us, and no pesin dey to free us from dia hands.
- We dey risk awa life just to get food to chop, becos killers dey for di desert [wey go attack us if we go awa farm].
- Awa skin hot like oven becos of di fever from hunger.
- Dem don rape awa women for Zion, dem dey use gra-gra sleep wit awa babes for di cities of Judah.
- Dem don hang princes wit dia hands; dem no gree respect senior-pipo.
- Dem force young men dey hustle for grinding stone, and boys fall becos of di heavy wood wey dem carry.
- Di senior-men no dey gada for di gates again; di young men don stop dia music.
- Happiness don komot from awa hearts; awa dance-dance don turn to cry-cry.
- Di crown don fall komot from awa head. Wahala for us becos we don do bad-bad-tins!
- Awa heart dey faint becos of dis, awa eyes dey close becos of dis tins
- Becos of di mountain of Zion wey don empty, foxes dey waka upandan for there.
- You oh Baba-God, you dey forever; your king-chair dey last from generation to generation.
- Why you dey always forget us forever? Why you dey fashi us tey-tey like dis?
- Carry us come meet you again, Oh Baba-God, so dat we go fit come back; make awa days new again like before.
- But you don pursue us komot kpatakpata, and you dey vex for us well-well.