Luke Chapter 1
Intro
- Plenty pipo don try to write about di tins wey don happun among us,
- just as those pipo wey first see am wit dia eyes, and wey con be servant of di word, put am for awa hand.
- So, as me sef don cool down torch-light everitin from di starting, e make-sense for me to write wetin happun—for you, Theophilus wey get level,
- so dat you go dey sure about everitin wey you learn.
Dem Predict As Dem Go Take Born John Di Baptist
5. For Herod time, wey be king of Judea, e get one priest wey dem dey call Zechariah, he be member of di priest-line of Abia; hin wife Elizabeth sef na from di daughters of Aaron.
6. Di two of dem dey live straight life for Baba-God eyes, dem dey keep all Baba-God commandment and dia life no get any error.
7. But dem neva get pikin becos Elizabeth no fit born pikin; and di two of dem don dey old.
8. One day, wen Zechariah group dey on duty, and he con dey serve as priest for Baba-God worship-place,
9. based-on di tradition of di priest, dem cast lot, con choose Zechariah, to enta Baba-God worship-place to burn incense.
10. And wen time reach wen dem go burn incense, everi-pesin gada, con dey worship and pray for outside.
11. Naso one of Baba-God angel show-face to Zechariah—di angel stand for di right side of di altar of incense.
12. Wen Zechariah see di angel, he con dey shake, and fear catch am.
13. But di angel con tell am sey: “Make your mind no dey cut Zechariah; Baba-God don hear your prayer. Your wife Elizabeth go born baby boy, and you go call di pikin name—John.
14. He go give you joy, and he go make you happy. Plenty pipo go happy wen dem born am,
15. he go be great pesin for Baba-God eyes. Make he no drink wine, or ogogoro, and he go brekete wit di Holy Spirit—even from wen he dey inside hin mama belle.
16. He go bring many pipo for Israel come back to Baba-God dia Oga.
17. Baba-God go give am di pawa and spirit of Elijah, to make papa heart turn to dia pikin, and make pipo wey no dey hear word—reason di wisdom of di good pipo, and to prepare di pipo wey Baba-God don arrange for hinsef.”
18. Zechariah con ask di angel sey, “How I go take dey sure of dis tin? I be old man, and my wife sef don dey old.”
19. Di angel ansa am, “Na me be Gabriel, and I dey stand for Baba-God front, and he send me to tell you dis message of good news.
20. And now you go dey silent, and you no go fit tok until di day wey dis tin go happun, becos you no believe wetin I dey tok—wey go soon happun wen time don reach.”
21. Di pipo bin dey wait for Zechariah, so dem con dey reason why he dey waste time for inside di worship-place.
22. As he come outside, he no fit follow dem tok anytin. Dem notice sey he don see vision for inside di worship-place, Zechariah just dey use hin hand give dem sign—becos he no fit tok.
23. Afta he finish hin days of service for di worship-place, he con go hin house.
24. Now afta those days, hin wife Elizabeth—get belle, and for five months she dey alone.
25. She sey, “Baba-God don do am for me. Dis days he don show me hin favour—con carry my disgrace komot among pipo.”
Dem Predict As Dem Go Take Born Jesus
26. For di sixth month, Baba-God send hin angel Gabriel—go Nazareth, for one town wey dem dey call Galilee,
27. to meet one virgin wey don engaged to one man wey dem dey call Joseph, wey be David pikin-pikin-pikin. Di virgin name na Mary.
28. Di angel go meet her, con tell her sey, “I dey greet you—wey Baba-God favour well-well! Baba-God dey wit you.”
29. Mary mind no rest for wetin di angel tell her, she dey reason which kain greeting be dat.
30. But di angel tell her sey, “Mary, no dey fear, Baba-God don favour you.
31. You go get belle, con born Man-pikin, and you go call am—Jesus.
32. He go be great man, and dem go call am Son of di Most High. Baba-God go give am di king-chair of hin papa—David,
33. and he go rule over all di house of Jacob forever; hin kingdom no go ever end.”
34. Mary con ask di angel sey, “How dis kain tin go take happun—wen I still be virgin?”
35. Di angel ansa her, “Di Holy Spirit go enta you, and di pawa of di Most High go cover you. So di pikin wey you go born go holy, and dem go call am Baba-God Son.
36. Even your cousin, Elizabeth go born pikin as she don old, and she wey pipo tok sey she no fit born pikin—don get six month belle.
37. Wit Baba-God notin go dey impossible.
38. Mary con ansa am, “I be Baba-God servant, make e happun as you don tok am.” Di angel con komot.
Mary Visit Elizabeth
39. Dat time, Mary ready, con rush go di town for di hill kontri of Judea,
40. na for there she enta Zechariah house, con greet her.
41. Wen Elizabeth hear Mary greeting, di pikin wey dey for her belle shake, and Elizabeth brekete wit Holy Spirit.
42. Nahin she con halla: “Blessings dey on you among women, and blessings for di pikin wey you go born!
43. But why Baba-God favour me like dis, wey di mama of my Oga go come visit me?
44. As I hear your greeting, di pikin wey dey for my belle shake wit happiness.
45. Blessings dey on you becos you believe wetin Baba-God don tok sey he go do.
Mary Song
46. Naso Mary tok sey: “Chai, my soul dey praise Baba-God.
47. and my spirit dey happy for Baba-God my Saviour!
48. He don reason di low- level of hin servant girl. From now on, all generations go call me blessing,
49. di great One don do ogbonge tins for me—Holy na hin name.
50. He dey sorry-for pipo wey dey respect am—from generation to generation.
51. He don use hin hand do ogbonge tins! He don scata those pipo wey dey make-mouth, and wey dey feel big for inside dia heart.
52. He don carry rulers komot from dia king-chair, and he don promote humble pipo.
53. He don give beta tins to pipo wey dey hungry—but he don pursue bigmen komot wit notin.
54. He don epp hin servant—Israel, he dey always remember to sorry-for hin pipo,
55. as he tell awa ancestors, Abraham and hin pikin-pikin- pikin forever.”
56. Mary stay wit Elizabeth for three months, and she con go back to her house.
As Dem Take Born John Di Baptist
57. Wen time reach for Elizabeth to born her pikin, she born baby boy.
58. Her neighbours and family pipo hear sey Baba-God don sorry-for her well-well—dem con happy for her.
59. For di eight day, dem circumcise di pikin, dem wan bin give am di same name wit hin papa Zechariah,
60. but hin mama tok sey, “No! Na John be hin name.”
61. Naso dem tell her sey, “No-pesin among una family pipo dey ansa dat kain name.”
62. So dem give hin papa sign to know which name he go give di pikin.
63. He con tok sey, make dem give am sometin to write put, everi-pesin surprise sey he write sey, “Hin name na John.”
64. Naso Zechariah mouth open sharp-sharp, so he start to dey tok again, con dey praise Baba-God.
65. All dia neighbours surprise, and pipo con dey spread di gist tru-out di hill kontri of Judea.
66. Everi-pesin wey hear wetin happun con surprise—dey ask sey, “Which kain pesin dis pikin go be?” Baba-God hand dey for hin body.
Zechariah Song
67. Hin Papa — Zechariah, wey di Holy Spirit brekete for hin body, con prophesy sey:
68. “Praise be to Baba-God, di God of Israel, becos he don come to save hin pipo.
69. He don raise up horn of salvation for inside di house of David hin servant,
70. just as he promise tru hin prophet tey-tey.
71. So dat we go free from awa enemies, and from di hand of everi pesin wey hate us—
73. He don sorry-for awa papa-papa-papa—as he remember hin holy agreement,
74. di oath wey he swear to awa papa Abraham:
75. to save us from awa enemies hand, and make we no fear as we dey serve am—
76. inside holiness plus goodness—for hin front, everi day of awa life.
77. And you my son, dem go call you prophet of di Most High; you go go for front—to clear road for di Oga.
78. You go tell hin pipo about salvation tru forgiveness of sins.
79. Becos of di softness wey Baba-God take dey sorry-for pesin, di sun wey dey rise—go come meet us from heaven—
80. to shine for those pipo wey dey live for inside darkness, and inside di shadow of death, to guide awa leg to di road of peace.”
81. Naso di pikin grow, con strong well-well for hin spirit; and he stay for inside desert until he show-face for Israel pipo.