Luke Chapter 24
As Jesus Take Rise Up From Di Dead
- For di first day of di week, very early in di morning, di women carry di spices wey dem don arrange—go di grave side.
- Dem con see sey di stone don roll komot from di grave,
- but wen dem enta inside, dem no see Oga Jesus body.
- As dem dey reason di mata, naso two men wey dia cloth dey shine like lightning con stand for dia side.
- So di women bow down face ground wit fear, but di men con tell dem sey, “Why una dey fyne pesin wey dey alive—among di dead?
- He no dey for here; he don raise up! Remember wetin he bin tell una wen he still dey wit una for Galilee:
- Dem must carry Man- pikin put for world-pipo hand, dem go nail am for cross, and on di third day—he go raise up again.’
- Dem con remember hin words.
- Wen dem come back from di grave side, dem gist di eleven disciples, and di rest of dem.
- Na Mary Magdalene, Joanna, Mary wey be James mama, plus some oda women—nahin tell di disciples dis tins.
- But dem no gree believe di women, becos e be like sey wetin dem dey tok no make-sense.
- Peter stand up con run go di grave side. As he bend enta, he see only di small linen cloth for ground, he komot, con go reason wetin don happun.
For Di Road To Emmaus
13. For dat same day two of dem dey go one village wey dem dey call Emmaus wey be about eleven miles from Jerusalem.
14. Dem dey gist wit each oda about everitin wey don happun.
15. As dem dey tok and dey gist di mata wit demsef, naso Jesus hinsef just show-face, con dey waka wit dem;
16. but dem no first know sey na Jesus be dat.
17. He con ask dem, “Wetin una dey tok as una dey waka dey go so, wey una dey feel sad?”
18. One of dem wey dem dey call Cleopas ask am sey, “Abi you be jjc (stranger) for Jerusalem wey you no know wetin don happun for here dis days?”
19. Naso he ask dem sey, “Wetin happun?” Dem con ansa am sey, “Na about Jesus of Nazareth, he be prophet wey hin words and hin works get pawa for Baba-God front, plus all di pipo.
20. Di chief priests, plus awa rulers make dem sentence am to death, and dem nail am for cross;
21. but we get hope sey nahin go save Israel. Na three days ago all dis tins happun.
22. And some of awa women make us surprise. Dem go di grave early dis morning,
23. but dem no see hin body. Dem con tell us sey dem see angel for vision wey tok sey Jesus dey alive.
24. Naso some of awa padi go di grave, con see sey wetin di women tok na true, dem no see Jesus for there.”
25. He con tell dem sey, “See as una mumu reach, and see as una heart dey do sme-sme to believe everitin wey di prophets don tok!
26. Abi Christ no suppose suffer all dis tins con enta inside hin glory?”
27. And starting wit Moses plus all di prophets, he explain to dem wetin dem tok for di Holy- books about hinsef.
28. As dem dey reach di village wey dem dey go, Jesus con do as if he still dey go front small.
29. But dem beg am sey, “Stay wit us, evening don dey reach; di day don dey dark.” Naso he enta di house, con stay wit dem.
30. Wen he dey for table wit dem, he carry bread, he give tanks, he cut am, con start to dey give dem.
31. So dia eyes con open, dem con notice am, and naso he just vanish from dia side.
32. Dem con dey ask demsef sey, “Abi awa heart no bin dey burn inside us as he dey follow us tok for road, and as he open di Holy-books for us?”
33. Naso dem stand up, con sharp-sharp go Jerusalem. Dem see di eleven disciples, and those pipo wey dey wit dem for there. All of dem gada togeda.
34. Dem tok sey, “Na true! Awa Oga don raise up, and he don show-face to Simon.”
35. Naso di two of dem tell dem wetin bin happun for road, and how dem take know sey na Jesus—wen he cut di bread.
Jesus Show-face To Hin Disciples
36. As dem still dey tok di mata, Jesus hinsef con stand wit dem, naso he tell dem sey, “Make peace dey wit una.”
37. Dem surprise and fear catch dem becos dem tink sey dem dey see ghost.
38. He tell dem sey, “Why una heart dey do gbim-gbim, and why una dey get two-mind?
39. See my hand and my leg. Na me be dis! Touch me make una see; ghost no dey get body plus bones—as una see sey I get.”
40. Wen he don tok dis tins finish, he con show dem hin hand and hin leg.
41. And as dem no still believe am becos of happiness and surprise, he con ask dem sey, “Una no get anytin for here wey pesin fit chop?”
42. Dem give am cooked fish, plus honeycomb,
43. and he collect am, con chop am for dia front.
44. Naso he tell dem sey, “Dis na wetin I tell una wen I still bin dey wit una: everitin wey dem write about me for di law of Moses, and di Prophets plus di Psalms—must come to pass.
45. So he open dia mind so dat dem go fit understand di Holy- books.
46. He tell dem sey, “Dis na wetin dem write: Christ go suffer, con raise up from di dead on di third day,
47. wit hin name, dem go preach sey make pipo repent—plus forgiveness of sins to all di nations, starting from Jerusalem.
48. Una be witness of all dis tins.
49. I go send una wetin di Fada don promise una, but make una stay for di city of Jerusalem—until una wear di pawa from up-up.”
As He Take Move Go Up
50. Wen he carry dem komot go Bethany, he carry hin hand go up, con bless dem.
51. As he dey bless dem, he komot from dem—con move go up to heaven.
52. Dem con dey worship am, and dem go back to Jerusalem wit serious happiness.
53. And dem dey for di worship-place everi time, dey praise Baba-God.