Mark Chapter 4

Abeg share

Di Parable Of Di Farmer

  1. Jesus con dey teach again for near di river. Di pipo wey gada round am plenty well- well—sote he con climb inside one boat wey dey for di river—as all di plenty pipo gada for di water side.
  2. He use parables take teach dem plenty tins, and from hin teaching dem, he tok sey:
  3. “Make una hear me! One farmer go plant seeds.
  4. As he dey plant di seeds, some of di seeds fall for road side, and some birds chop dem.
  5. Some fall for where stones dey, for where sand–sand no plenty. Di seeds quick-quick grow becos di sand no deep.
  6. But wen sun rise, di plant con burn, and dem no fit grow becos dem no get root.
  7. Some seeds fall for where shuku-shuku dey, di shuku- shuku grow, con shuuk di plants sote dem no fit produce fruit.
  8. Some oda seeds fall for beta soil. E grow, con turn to plant wey produce thirty, sixty and hundred times.”
  9. Naso Jesus tok sey, “Pesin wey get ears, make e hear.”
  10. Wen he dey alone, di twelve disciples and some oda pipo con gada am—dey ask am about di parable wey he tell dem.
  11. He tell dem sey, “Di secret of Baba-God kingdom don already dey wit una, but everitin be like parable to those pipo wey no belong,
  12. so dat, “ ‘Dem go dey see, but dem no go fit observe, and dem go dey hear but dem no go fit understand; if not dem for change, and Baba-God go forgive dem!’ ”
  13. Naso Jesus tell dem sey, “Una no understand dis parable? How una go fit understand any parable?
  14. Di farmer dey plant di word.
  15. For where dem plant di word put, some pipo be like seeds wey fall for road side. As dem just hear di word, Satan steal di word wey dey grow for dia mind.
  16. Odas be like seeds wey fall for where big-big stones plenty put, dem hear di word wit happiness,
  17. but becos dem no get root, dem no last at all. Wen wahala and katakata show becos of di word, dem sharp-sharp park- well.
  18. Odas be like seeds wey fall for where shuku-shuku dey, dem hear di word;
  19. but worry-worry of dis life, and as moni dey deceive dem, and dia mind wey need plenty tins con go press di word for neck, and dem no fit produce anytin.
  20. Odas be like seeds wey fall for beta soil, dem hear di word, dem   accept   am,   con   produce fruit— thirty, sixty, or evensef—hundred times wetin dem plant.”

Lamp Wey Dey For E Stand

21. He con tell dem sey, “Who go light lamp, con put am under bowl, or under bed? Instead, dem go put am for e stand.

22. Notin wey dem hide wey no go show come out, and anytin wey dem keep for secret—go show come out for light.

23. Any-pesin wey get ears to hear, make e hear.”

24. He con tok sey, “Dey reason wetin you dey hear. Di more you dey listen, di more you go dey understand—and you go understand even more.

25. Any-pesin wey get—go get more, any-pesin wey no get shi- shi—dem go collect even di small tin wey he get.”

Di Parable Of Di Seed Wey Dey Grow

26. He con still tok sey, “Naso Baba-God kingdom be. One man plant seed for ground.

27. For night or for day, whether he dey sleep or he dey awake, di seed go form, even if he no understand how e take dey happun.”

28. Di soil go produce fruit by esef—first of all di leaves go form, den di head go form, and las- las, di seed go ripe.

29. As di fruit just ripe finish, di farmer go harvest am, becos harvest don reach.”

Di Parable of Di Mustard Seed

30. Naso he con still tok sey, “Wetin we go tok sey Baba-God kingdom be like, or which parable we go use take explain am?

31. E be like mustard seed wey be di smallest seed wey you fit plant for ground.

32. But as dem plant am finish, e go grow, con big pass oda trees, wit branches wey big well- well, sote birds wey dey fly for air fit build dia house put.”

33. Jesus use plenty parables take follow dem tok. Plenty parables wey dem fit understand.

34. He no follow dem tok unless he use parable. But as he dey alone wit hin disciples, he explain everitin to dem.

Jesus Make Di Heavy-Breeze Kpanji

35. Dat day, wen evening don reach, he tell hin disciples sey, “Make we go di oda side.”

36. Dem komot leave di plenty pipo, he dey inside di boat wit dem. Some oda boat follow dem.

37. Heavy-breeze start to dey blow, and di waves con dey rush enta inside di boat, sote di boat con dey sink.

38. Jesus dey for di back of di boat—he dey sleep for cushion. Di disciples wake am up con tell am sey, “Teacher, you no-send as water wan carry us go?”

39. He stand up, he command di heavy breeze, con tell di waves sey, “Sharrap! Dey one place!   Naso   di   heavy   breeze kpanji—everi-where con segemenge.

40. So he tell hin disciples sey, “Why una mind dey cut? How e be sey una no get faith?”

41. Fear con dey catch dem, as dem dey ask demsef sey, “Who be dis? Even di heavy breeze plus di waves—dey obey am!”

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *