Matthew Chapter 1
Jesus Family-line
- Dis na di history of all di generations of Jesus Christ, David pikin, wey be Abraham pikin:
- Abraham nahin born Isaac; Isaac con born Jacob; Jacob con born Judah and hin brodas.
- Judah con born Pharez wey born Zerah wey hin mama na Thamar; Pharez born Thamar; Thamar con born Ram;
- Ram born Aminadab; and Aminadab con born Nashon wey con born Solomon;
- Solomon born Boaz wey hin mama na Rahab; and Boaz born Obed wey hin mama na Ruth;
- Jesse nahin be David papa wey con be king; David con born Solomon wey hin mama bin marry Uriah;
- Solomon born Roboam; wey born Abijah; Abijah con born Asa;
- Asa born Jehoshaphat; and Jehoshaphat con born Joram wey born Uzziah;
- and Uzziah born Joatham; and Joatham con born Ahaz wey con born Hezekiah;
- Hezekiah born Manasseh; and Manasseh born Amon and Amon born Josiah;
- and Josiah born carry he and hin brodas for slavery;
- Afta dem carry dem enta Babylon, Jeconiah born Shealtiel wey born Zerubbabel;
- and Zerubbabel born Abiud wey born Eliakim wey con born Azor;
- Azor con born Zadok wey born Akim; and Akim born Eluid;
- Eliud born Eleazar; and Eleazar con born Matthan; and Matthan born Jacob;
- and Jacob born Joseph wey be di husband of Mary wey con born Jesus wey dem dey call Christ.
- So all di generations from Abraham to David na fourteen generations; and from David reach di time of Babylon na fourteen generations, and from di time wey Babylon pipo show, reach Jesus time na fourteen generations.
- Naso dem take born Jesus. Mary hin mama and Joseph bin wan marry demsef, but before dem marry, naso Holy Spirit put pikin inside Mary belle.
- Becos Joseph her husband na good man, and he no wan disgrace her for publik, so he con plan to pursue Mary komot codedly.
- Afta he don reason di mata, naso Baba-God angel show- face for inside hin dream, con tell am sey, “Joseph, David pikin, make you no fear to marry Mary becos na di Holy Spirit put di pikin inside her belle.
- She go born di son, and make you call hin name Jesus; becos he go save hin pipo from dia sins.”
- All dis tins happun to confam wetin di prophet tok:
- “One virgin go get- belle, con born pikin, and dem go call di pikin name Emmanuel”—wey mean, “Baba-God dey wit us.”
- As Joseph wake up, he do wetin di angel tell am to do. He marry Mary.
- But he no sleep wit her until she born di pikin. And he name di pikin—Jesus.