Jesus Send Di Twelve Go Out
- He call hin twelve disciples, con give dem pawa to drive evil spirit komot, and to heal everi disease and sickness.
- Dis na di names of di twelve disciples: first, na Simon (wey dem dey call Peter) plus hin broda Andrew; James—son of Zebedee, plus hin broda John;
- Philip plus Bartholomew; Thomas and Matthew di tax collector; James son of Alphaeus, and Thaddaeus;
- Simon wey over- serious, plus Judas Iscariot, wey betray Jesus.
- He send di twelve disciples komot—wit some instructions: “Make una no go where di Gentiles dey, or enta any town of di Samaritans.
- Instead, make una go meet di lost sheep of Israel.
- As una dey go, make una preach dis message: ‘Di kingdom of heaven dey near una.’
- Heal pipo wey dey sick, raise up dead pipo, heal those pipo wey get leprosy, pursue bad-spirit komot. Make una give for free—as una take receive as awoof.
- Make una no carry any gold or silver or copper for una belt;
- no carry any bag for di journey, or extra cloth, or sandals or staff; na where man dey work na for there he dey chop.
- “Any town or village wey una enta, make una fyne one man wey una fit trust, con stay for hin house until una komot.
- As you enta di house, greet dem.
- If na beta house, show dem your peace; if not, keep your peace to yoursef.
- If any-pesin no welcome una or listen to wetin una dey tok, shake di dust komot from your leg as you dey komot from di house or town.
- I dey tell una di truth sey, wetin dat town go use dia eyes see go pass wetin Sodom and Gomorrah go suffer for di day of judgement.
- I dey send una komot like sheep among wolves. Make una dey innocent like dove, con wise like snake.
- “Make una shine una eyes for men; dem go carry una give di local councils, and dem go flog una for inside dia worship-place.
- Becos of me, una go face govnors plus kings, dis na opportunity for you to tell di rulers and world-pipo about me.
- But wen dem arrest una, make una no worry about wetin una go tok or how una go take tok am. Wen dat time reach, Baba-God go tell you wetin you go tok,
- no be you go dey tok, but na di Spirit of di Fada go dey use you tok.
- “Broda go betray broda to death, and papa go betray pikin; pikin go change-am-for dia mama and papa—con even kill dem.
- All men go hate you becos of my mata, but las-las pesin wey stand gidigbam go dey saved.
- Wen dem show una pepper for one place, run go anoda place. I dey tell una di truth, una no go fit waka all di cities of Israel before Man-pikin go show.
- “Student no fit pass hin teacher, or make servant pass hin oga.
- E dey okay for di student to be like di teacher, and di servant fit be like hin oga. If dem fit call me devil-pikin, wetin dem go con call una!
- “So make you no fear dem. Notin wey dem put for inside darkness wey no go come out, or wey dem hide, wey no go show- face for light.
- Wetin I dey tell una for dark, make una tok am for afternoon; wetin dem tok small- small for inside ears, make una tok am for on top of house.
- No fear pipo wey fit kill your body but wey no fit kill your soul. But fear di pesin wey fit kill both your body and soul for hell.
- No be chikini moni dem dey sell two birds? But even one of dem no fit fall for ground except na Baba-God will.
- All di hair wey dey for your head get numba.
- So no dey fear; you get levels pass birds.
- Any-pesin wey tok about me to men, I go yarn about am to my papa wey dey for heaven.
- But any-pesin wey deny me for front of men, me sef go shenk am for front of my papa for heaven.
- “No go dey reason sey I don bring peace come dis earth. I no bring peace come, but na sword I carry come.
- I don come to ‘make man—change-am-for hin papa, daughter against her mama, daughter-in-law against her moda- in-law—
- man enemies go be members of hin own house.’
- “Any-pesin wey love hin papa or mama pass me—neva ready for me; any-pesin wey love hin pikin pass me, neva ready for me;
- and any-pesin wey wan follow me but no fit carry hin own cross—neva ready for me.
- Any-pesin wey dey keep hin life go lose am, and any- pesin wey lose hin life becos of me, go gain am.
- “Pesin wey receive you—don receive me, and pesin wey receive me—don receive di pesin wey send me.
- Any-pesin wey welcome prophet, becos he be prophet—go receive prophet blessings, and any-pesin wey welcome good man, becos he be good man—go receive good man blessings.
- And if any-pesin give even if na cup of cold water to one of dis small pikin, becos dem be my disciple, I dey tell una di truth, di pesin no go ever lose hin blessings.”
Post Views: 57