Matthew Chapter 24

Abeg share

Signs Sey Di World Don Dey End

  1. Jesus komot from di worship-place con dey waka dey go—hin disciples con call am sey make he see di fine building.
  2. He con tok sey, “Una dey see all dis tins so? I dey tell una di truth sey, no single stone go fit stay on top anoda stone; all di stones go scata for ground finish.”
  3. As Jesus sidon for di Mount of Olives, di disciple go meet am for corner con ask am sey, “Tell us wen all dis tins go happun, and wetin go be di sign sey you dey come, and di sign of di end of dis world?”
  4. Jesus ansa dem: “Shine your eyes make any-pesin no scam una.
  5. Plenty pipo go show wit my name, con tok sey, ‘Na me be di Christ,’ and dem go scam plenty pipo.
  6. Una go hear about wars and gist about wars, but make sure sey una mind no cut. All dis tins must happun but di end neva still reach.
  7. Nations go change-am-for nations, and kingdoms go change-am-for kingdoms. Hungry go dey, and earthquake go dey for plenty places.
  8. All dis one na di starting of pains.
  9. “Dem go carry una go show una pepper, con kill una, and all nations go hate una becos of me.
  10. Dat time, many pipo go run komot from di faith, con betray and even hate demsef,
  11. and plenty fake prophets go show, con play plenty pipo wayo.
  12. Becos of how wickedness go burku reach, plenty pipo no go dey show love again.
  13. But pesin wey stand gidigbam reach di end—nahin Baba-God go save.
  14. And dem go preach dis good news about Baba-God kingdom for di whole world, so dat everi nation go hear am, na dat time di end go reach.
  15. “So wen una see di ‘Tufiakwa of scata-scata,’ dey stand for di holy place, wey prophet Daniel tok about—make di reader understand,
  16. dat time make everi- pesin wey dey for Judea run go di mountain.
  17. Make no pesin wey climb on top hin house go down go take anytin komot from di house.
  18. Make no-pesin wey dey for farm go back house to collect hin cloth.
  19. Those days no go good at all for woman wey get belle, and woman wey her pikin dey suck breast!
  20. Pray sey your flight no dey for cold season or for Sabbath.
  21. Dat time serious suffer- suffer go dey, wey pass di ones wey pipo don see since di starting of dis world reach now—and no suffer go ever reach like dat again.
  22. If to sey Baba-God no minus from di numba of those days, no-pesin for fit survive am, but becos of di chosen ones, those days no go plenty again.
  23. Dat time if any-pesin tell una sey, ‘Look, see di Christ for here!’ or ‘See am for there!’ make una no believe am.
  24. Fake christs and fake prophets go show-face, con do ogbonge signs, plus miracles, to scam even di chosen ones—if e dey possible.
  25. See, I don already tell una down.
  26. “So if any-pesin tell una sey, ‘He dey for there, he dey for desert,’ make una no go; or, ‘He dey here, for inside di inner rooms,’ make you no believe am.
  27. As lightning wey dey come from di east, and pipo wey dey west go see am, naso Man- pikin go take show.
  28. Any place wey animal deadbody dey, na for there vultures dey gada.
  29. “Afta di palava of those days, di sun go con dark and di moon no go shine again; di stars go fall komot from di sky, and di pawas of di heavens go shake.
  30. “Na dat time di sign of Man-pikin go show for sky. And all di nations wey dey for di earth go start to dey cry, dem go see Man-pikin dey come from di cloud—for sky, wit pawa plus heavy levels.
  31. And he go send hin angels wit loud trumpet wey dey halla, and dem go gada di chosen ones from all over di world—from di end of di earth reach heaven.
  32. “Now make una learn dis lesson from fig tree: as e branches and leaves just start to dey come out, you go know sey hot season don dey reach.
  33. Evensef, wen you see all dis tins, make una know sey di time don dey reach, time dey for door.
  34. I dey tell una di truth, dis generation no go pass until all dis tins happun.
  35. Heaven and earth go pass komot, but my words no go ever pass komot.

No-pesin Know Di Day And Di Hour

36. “No-pesin know di day or di hour, even di angels for heaven no know, even Man-pikin sef no know, but only di Fada nahin know.

37. As e happun for di days of Noah, naso e go be wen Man- pikin go show.

38. Di days before di flood happun, pipo dey chop, dem dey drink, dem dey marry and dem dey give pipo for marriage, until di day wey Noah enta di ark;

39. and dem no know wetin go happun until di flood con carry all of dem go. Naso e go be wen Man-pikin go show.

40. Two men go dey for farm; one go move go—leave di oda one.

41. Two women go dey grind sometin; one go move go—leave di oda one.

42. “So make una dey watch becos una no know di day wey di Oga go come.

43. But make una understand dis: If di owner of house know di time wey tiff go show, he for watch, so dat dem for no break enta hin house.

44. So you must ready, becos Man-pikin go show for hour wey una no expect am.

45. “Who con be di faithful and wise servant, wey hin oga don put in charge of di oda servants for di house, to give dem dia food for di right time?

46. E go good for dat servant—as hin oga go happy, wen he come meet di servant dey do wetin he tell am to do.

47. I dey tell una di truth, dat oga go make am dey in charge of everitin for di house.

48. But if to sey dat servant wicked, con tell hinsef sey, ‘My oga no go come back now,’

49. he con start to dey beat hin fellow servants, con dey chop and drink wit ogogoro-men.

50. Di oga of di servant go land for day wey he no expect am, and for hour wey he no know.

51. He go cut am to pieces con put am for where fake-pipo dey, where dem go dey cry and dey bite dia teeth wit pain.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *