Matthew Chapter 26
Di Bad Plan For Jesus
- Wen Jesus don tok all dis tins finish, he con tell hin disciples sey,
- “ As una know, di Passover na two days time—and dem go carry Man-pikin go hang for cross.”
- Di chief priests plus di senior-men of di pipo, gada demsef for di high priest palace, wey hin name na Caiaphas,
- and dem plan to use style arrest Jesus, con kill am.
- Dem tok sey, “But no be for di time of di Festival, becos di pipo fit riot.”
Pesin Anoint Jesus For Bethany
6. As Jesus dey for Bethany, for one man house wey dem dey call Simon wey bin get leprosy,
7. one woman come meet am wit alabaster box of perfume wey cost well-well, wey she pour for hin head as he sidon near di table.
8. Wen di disciples see wetin she do, dem con vex sey, “Which kain waste be dis?
9. You for sell dis perfume, collect beta moni wey you for give poor pipo.”
10. As Jesus hear wetin dem tok, he con tell dem sey, “Why una dey disturb dis woman? She don do beta tin to me.
11. Poor pipo go always dey wit una, but I no go always dey wit una.
12. Wen she pour dis perfume for my body, she do am to prepare me for my burial.
13. I dey tell una di truth, any place wey dem preach dis good news for inside di whole world, dem go use dis tin wey she don do take remember her.”
Judas Agree To Betray Jesus
14. One of di twelve—di one wey dem dey call Judas Iscariot—go meet di chief priests
15. Di Pharisees con go dey plan how dem go take catch Jesus wit hin words.
16. Dem send dia disciples and di Herodians go meet am. Dem con tok sey, “Teacher, we know sey you be man wey pipo dey respect, and you dey teach Baba-God way based-on di truth. Men no fit whyne you becos you no wan know who dem be sef.
Di Oga Night-food
17. For di first day of di Festival of di Unleavened Bread, di disciples come meet Jesus, con ask am sey, “Where you wan make we arrange for you to chop di Passover?”
18. He con tell dem sey, “Waka go inside di city, go meet one man, tell am sey, ‘Di teacher tok sey: My time don reach finish. I go celebrate di Passover wit my disciples for your house.’ ”
19. So di disciples do wetin Jesus tell dem to do, con arrange for di Passover.
20. Wen evening reach, Jesus sidon wit dem for table.
21. As dem dey chop, he con tok sey, “I dey tell una di truth, one of una go betray me.”
22. Dem no happy at all, con dey tok sey, “Hope sey no be me, Oga?”
23. Jesus con tok sey, “Di pesin wey go betray me don put hin hand for inside bowl wit me.
24. Man-pikin must kpeme as dem bin write am, but kasala for di man wey go betray Man-pikin! E for beta for am if to sey dem no born am.”
25. Naso Judas, di pesin wey dey betray am con tok sey, “Master abi na me?”
Jesus con ansa am, “You don tok am.”
26. As dem dey chop, Jesus carry bread, he give tanks, naso he cut di bread, he give hin disciples—con tok sey, “Take, make una chop; dis na my body.”
27. He con carry di cup, he give tanks—con give dem, naso he tok sey, “Make all of una drink am.
28. Dis na my blood of di agreement, wey I pour as sacrifice to forgive plenty pipo sins.
29. I dey tell una sey, I no go drink wine again until dat day wen I go drink am fresh wit una—for my Papa kingdom.”
30. Afta dem don sing hymn, dem con go di Mount of Olives.
Jesus Tok Sey Peter Go Deny Am
31. Naso Jesus tell dem sey, “Dis night all of una go fashi me, dem write am sey: “ ‘I go attack di shepherd, and di sheep go jakpa.’
32. Afta I don raise up, I go move go Galilee.”
33. Peter con ansa am, “Even if everi-pesin fashi you, no be me.”
34. Naso Jesus tok sey, “I dey tell you di truth, dis night before di cock crow, you go deny me three times.”
35. Peter con tok sey, “Even if I go die wit you, I no go ever deny you.” Naso all di disciples tok di same tin.
Gethsemane
36. Jesus carry hin disciples go one place wey dem dey call Gethsemane, he con tell dem sey, “Sidon for here make I waka go front go pray.”
37. He carry Peter and Zebedee two sons follow-body, and he con dey feel sad—wit plenty wahala for hin head.
38. Naso he tell dem sey, “My soul dey heavy me wit sorrow like sey I wan die. Make una stay for here—dey watch wit me.”
39. He con waka go front small, he put hin face for ground con dey pray, “My Fada, if e dey possible, carry dis cup from me. But no be by my wish, but na as you wish.”
40. He turn look hin disciples, con see sey dem dey sleep. Naso he ask Peter, “So una no fit watch wit me for one hour make una no sleep?”
41. “Watch and pray make you no fall inside temptation. Di spirit ready, but di body dey do sme-sme.”
42. He komot again di second time go pray, “My Papa, if e no dey possible for dis cup to komot unless I drink am, make your will happun.”
43. Wen he come back, he still see hin disciples dey sleep becos sleep don full dia eyes.
44. He leave dem, con waka go again, he pray di third time—he pray di same tin.
45. He go meet di disciples, con tell dem sey, “Una still dey sleep and chill? See, di hour don reach finish, and dem go betray Man-pikin to sinners.
46. Wake up, make we dey go! See di pesin wey go betray me dey come!”
Dem Arrest Jesus
47. As he still dey tok, Judas—one of hin disciple con show. Plenty plenty pipo wey carry sword and kpako—wey di chief priests and di senior-men send, follow am come.
48. Judas don plan wit dem wit sign: “Di pesin wey I go kiss nahin be di man; make una arrest am.”
49. Naso Judas waka straight go meet Jesus, he con tok sey, “I hail you teacher!” He con kiss am.
50. Jesus ansa am, “Padi, do wetin you come do.” Naso di men grab Jesus, con arrest am.
51. So, one of di disciples carry hin sword, con cut di ear of one of di high priest servant.
52. Jesus con tell am sey, “Keep your sword, any-pesin wey dey use sword, dem go kill am sef wit sword.
53. Abi you tink sey I no fit call my Papa make he send twelve battalions of angels come for me?
54. But how di Holy-books go take come to pass, wey tok sey e go must happun like dis?”
54. Now Jesus con tell di pipo sey, “Una come fyne me wit sword and kpako like sey I be robber? Everi day I follow una sidon for di worship-place dey teach and una no arrest me.
56. But all dis tins dey happun so dat wetin di prophets don write go fit come to pass.” All di disciples con jakpa.
For Front Of Di Council
57. Those pipo wey arrest Jesus carry am go Caiaphas—di high priest, where di teachers of di law and di senior-men gada.
58. But Peter dey far- far—con follow dem reach di high priest palace. He enta, con sidon wit di servants to know wetin go happun las-las.
59. Di chief priests, plus di full council dey fyne wetin dem go use lie for Jesus head—so dat dem go fit kill am.
60. But dem no see anytin out of all di lie wey dem form. Las- las, two of dem show,
61. con tok sey “Dis man tok sey, ‘I go fit scata di worship-place of Baba-God, con build am back in three days.’ ”
62. Di high priest stand up, con tell Jesus sey, “Abi you no go ansa? Wetin be dis tin wey dis men dey tok about you?”
63. But Jesus no tok anytin. Di high priest con tell am sey, “I wan make you swear wit di name of di living God: Tell us if na you be di Christ, di son of Baba-God.”
64. Jesus con tok sey, “Yes, as you tok am, naso e be. But I dey tell una sey: for future, una go see Man- pikin dey sidon for di right hand of Baba-God, and he go follow di cloud of heaven dey come.”
65. Naso di high priest tear hin cloth, con tok sey, “Dis man dey down-grade Baba-God! Why we still need any witness? See now, una don hear as he take dey down-grade Baba-God.
66. Wetin una tink? Dem con tok sey, “He suppose die.”
67. Naso dem spit for hin face, and dem blow am wit dia hand. Some of dem dey slap am,
68. con tok sey, “Christ, prophesy to us who nack you?”
Peter Deny Jesus
69. As Peter dey sidon for di palace, one house-girl come meet am, con tell am sey, “You sef dey wit Jesus of Galilee,”
70. But he deny am for dia front, “I no know wetin you dey tok.”
71. Naso he waka go di gate side, anoda girl see am, con tell pipo sey, “Dis man bin dey wit Jesus of Nazareth.”
72. Dis time Peter deny am again, con swear sey, “I no know di man before!”
73. Small time, those pipo wey dey stand for one corner waka go meet Peter—con tok sey, “E be like sey you be one of dem, di way you take dey tok don already show who you be.”
74. Naso Peter con dey swear for hin own head sey, “I no know dis man before!” Naso one cock just crow.
75. So Peter remember wetin Jesus tell am: “You go deny me three times before di cock go crow.” Naso he waka go one corner con dey cry well-well.