Matthew Chapter 8

Abeg share

Di Man Wey Get Leprosy

  1. Wen Jesus come down from di mountain, plenty pipo follow am.
  2. Naso one man wey get leprosy kneel down for hin front—con tok sey, ‘Chai my Oga, you fit heal me if naso you want am!’
  3. Naso Jesus touch di man, con tok sey, “I wan make you dey alright. Oya receive your healing!” Naso di man sharply heal from hin leprosy.
  4. 4. Jesus con tell am sey, ‘No gist any-pesin wetin happun oh. But you fit go show yoursef to di priest, and make you go give di offering wey Moses tell una make una give—as testimoni for dem.”
  5. Wen Jesus enta Capernaum, one oga for army come meet am, con dey ask am for epp.
  6. He tok sey, “Oga my servant dey suffer well-well for house and hin body don paralyze.”
  7. Jesus con tell am sey, “I go come heal am for your house.”
  8. So di soja tok sey, “Oga, I no get levels reach for you to enta my house. But just tok di word and my servant go heal.”
  9. Mesef, I be man wey dey under pawa, and wit plenty sojas wey I dey command. I go tell one sey, ‘Go,’ and he go go; and I go tell anoda one sey, ‘Bia,’ and he go come. I go tell my servant sey, ‘Do dis,’ and he go do am.”
  10. Wen Jesus hear wetin di man tok, he surprise, con tell di pipo wey dey follow am sey, “I dey tell una di truth, I neva see pesin wey get dis kain ogbonge faith for Israel.
  11. I dey tell una sey plenty pipo go come from di east and west, and dem go sidon for di party wit Abraham, Isaac and Jacob for di kingdom of heaven.
  12. But na for inside darkness—where pipo dey cry, and pipo dey bite dia teeth wit pain—nahin Baba-God go pursue di sons of di kingdom.”
  13. Jesus con tell di army commander sey, “Dey go house! Your servant don already heal as you believe.” And hin servant con true-true heal di time wey Jesus tok am.
  14. As Jesus enta Peter House, he see Peter wife-mama lie down for bed wit fever.
  15. He touch her hand and di fever vanish, naso she stand up con make food for dem.
  16. Wen evening reach, dem carry plenty pipo wey bad-spirit possess come meet Jesus, and he pursue all di spirit komot wit one single word, and he heal all di pipo wey dey sick.
  17. Dis one confam wetin Baba-God bin tok tru prophet Isaiah: “He carry awa sickness plus disease komot.”
  18. Wen Jesus see di plenty pipo wey gada round am, he con tell dem sey he wan cross go di oda side of di water.
  19. Naso one teacher of di law come meet am, con tell am sey, “Teacher, I go follow you go anywhere you go.”
  20. Jesus ansa am sey, “Foxes get holes, and birds wey dey fly for sky get bird-house, but Man-pikin no get where to rest hin head.” Gadarenes, two men wey evil spirit dey worry— come out from di graves come meet Jesus. Pipo no dey pass di area again becos di men fit fight pesin.
  21. Dem con dey shout for Jesus, “Wetin you want from us Jesus, Baba-God pikin? Abi you don come here to suffer us before awa time reach?”
  22. Plenty pigs dey for one corner for there, dey chop for around where dem dey.
  23. Di evil spirit con beg Jesus sey, “Abeg, if you wan pursue us, pursue us go those pigs body.”
  24. Naso he tell dem sey, ‘Oya make una dey go!” So dem komot—go enta di pigs body. All di pigs crase enta di deep water—con kpeme.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *