Nahum Chapter 3
Judgement Against Nineveh
- Wahala for di city of blood, city wey brekete wit lie-lie, city wey brekete wit robbers, and dem dey always oppress pipo!
- Hear di noise of koboko, di noise of di movement of di tyres, di sound of horse wey dey move, and di horse-moto wey dey jump.
- See as di sword of horse-riders dey flash wit dia long-sharp-weapon! Plenty-plenty pipo don die, and deadbody brekete for ground, deadbody full everi where—deadbody too plenty sote pipo dey march dem con dey fall;
- becos of di plenty-plenty ashawo ways of di olosho (Nineveh), di fine ashawo, di madam of witch—wey dey sell nations tru her olosho [idol worship], and wey dey sell families tru her witch.
- Baba-God Almighty tok sey, “I dey against you, I go use your skirt take cover your face. I go show di nations your nakedness, and I go show di kingdoms your shame.
- I go cover you wit yama-yama, con show di world as you true-true wicked reach.
- E go happun sey all di pipo wey see you go run from you, con tok sey, ‘Nineveh don scata finish! Who go cry for her?’ Where I go fit see any pesin wey go make you calm down?”
- Abi you beta pass No Amon, wey dey near di River, wit water round her, wey di river be her wall, and di deep-deep water be her fence?
- Ethiopia plus Egypt na her pawa; Put and Lybia dey epp her,
- But enemies still carry her komot as prisoner, and she enta foreign land. Dem cut her small-small pikin to pieces for front of everi street, dem cast lot* to share her top-men, con chain all her great men.
- You sef [Nineveh] go jogodo [wit di cup of Baba-God vex], con kpanji, and you go fyne place shuuk-head becos of your enemies.
- All di place where you dey hide be like fig trees wit dia first ripe fruit; wen pipo shake di trees, di fig go fall enta dia mouth.
- See una sojas, all of dem na women! Di gates of una town go open wide for enemies; faya go burn una iron gates.
- Una enemies wan surround una, so gada water keep! Make una wall strong well-well! Start to dey make blocks, gada clay, organize di material for blocks.
- Na for there di faya go burn una; di sword go cut una down, and enemies go chop una like locust. Make una gada like locust, Make una plenty well-well like locusts!
- Your market-pipo don plenty sote dem plenty pass stars for sky, but like locust, dem dey chop di land kpatakpata, con fly komot.
- Your commanders be like plenty locusts, and your generals be like plenty grasshoppers wey dey gada for wall on a cold day—but wen sun show-face, dem go fly komot, and no pesin dey know where dem dey go.
- Chai king of Assyria, your shepherds dey sleep, your rulers dey lie down for dust. Your pipo scata full di mountains wit no pesin to gada dem.
- Notin fit heal your wound; your injury serious well-well. Everi pesin wey dey hear di news about you dey clap dia hands sey you don fall, abi who no feel your wickedness wey no dey finish?